niginfolog2.gif (11208 bytes)

 

 

 

Comments Joint Contd.

Pa Mugo, the Senator of the Masses



 

December.19.2001

Eleganza “Heaven on Earth” Estate: Who get that kind money?

My fellow Obodians, how dey go dey, I hope say una dey kampe? I don hear another one o, I hear am for Lagos say Eleganza Group of Companies don open their new Estate for Ikoyi area. My people, no be kind place wey people like us fit dey live o. Last week I hear wey some people dey talk am say the Manager for the place talk say he go cost between $35,000 and $50,000 per year if you want rent the place. My people, no be say I make mistake for the money own o, na the thing wey dem put for paper be that. Dem talk am say the cheapest for the place na $35,000 American Dollars. This one no be mistake, I no dey talk about Trinidad and Tobago Dollar. Canadian Dollar nko, no be am. And wetin dem dey call that Country for South America wey dem talk say dem want change their money to Dollar? He be like say na Venezuela or Argentina, but any way sa,  no be that kind Dollar. I dey talk about the money for God’s own Country, the US of A. Na the kind dollar dem talk be that. Na him be say if to say na soso Naira you get under your mat for village, make you no appear with your Ghana must go bag because, dem go disgrace you. That one na joke, dem dey take local Money. 

My people jokes apart, no be say I dey talk say the company no fit put any price wey wey him like for his Estate. And I no talk say make people wey get that kind money no buy am, but the thing be say, na our people dey talk say make person look him backyard before he do things. If you take that kind money go Mallam Place for Keyside for Lagos Island go change am, I no think say you go fit carry that kind money for hand by yourself. I dey talk 4.5 million Naira per year for the place. My fellow Obodians, this na the cheapest o. If you dey talk about the $50,000 own that one go cost you 6.5 Million Naira. Osanobua! Seh seh seh my brother, na person wey rich go die well o. Which kind Barawos go pay that kind money for rent if him no dey do one kind 419? My people even for Lagos own, that money go build better bungalow for Ikeja area, I no dey talk about Mushin or Ajegunle o, I mean better place for this our Eko Akete. And if to say na my village you carry am go, na him be say you don become Kingsmaker be that. Kia kia our Igwe/Emir/Oba go make you him Royal advisor. This poku money for rent ?, I want know the kind Ole dem wey go put that kind money down just like that for rent, when no be say craze dey craze am. My people he be like say una no hear me o, we dey talk about our Lagos Nigeria o, the place wey United Nations talk say 60% of our people dey live below poverty, and a place wey na soso oyinbo pass me down we dey wear and use. This na country wey 90% of him University Graduates no get work and just dey waka about o.  The obodo wey dey call Giant of Africa and plenty of him road na dead traps and the thing wey dem dey call Middle Class na history as the country don become either you dey rich yanfuyanfu or you and the Rats wey dey for Okokokomaiko church we no sabi person wey poor pass.

I sabi say plenty of our Leaders and Olowo dem dey follow America own but the thing be say for God’s own Country, dem get the kind economy wey fit support that kind thing. Plenty of dem people especially Middle Class fit afford plenty thing wey our rich people dey take do yanga for Lagos and Abuja. New York City wey our Leaders dem dey follow follow, plenty people wey dey pay that kind money for Manhattan na Millionaires for Dollars no be our own  Naira o. From the thing wey my brother tell me, plenty people wey fit spend that kind money no be politicians but businessmen and women wey their financial portfolio full pass shit wey dey for Oyingbo area. So my people the thing wey I dey talk be say before we start dey build Plush and choice Flats as our Wannabes dey call am, make we make sure say plenty of our people go fit afford am.

We dey talk say crime dey, na this kind thing dey make some people turn to Armed Robber and Pen Robbers as plenty of our so call Leaders be. If we dey talk about Corruption and say we want commot am for our Obodo, he go good if plenty of our Super Millionaires go look themselves for mirror and change the person wey dey see first. Na him be say plenty of the thing na dem dey cause am. Where all these people wey dey build all these Plush houses want make our people find that kind money? And which kind expertrate dem think say fit afford am? I know say my body never reach Obodo Oyinbo border before but from the thing wey I dey hear and see for CNN, all these Dimplomats no fit afford that kind rent unless dem dey do one kind wayo for Embassy wey their government no sabi. These people na the same civil servant we get for our Obodo, their government no dey pay dem that kind money for salary. And make dem no tell me say na all these so call Technicians wey we dey call Expertrate for Nigeria go dey live for that kind place because these people for their country, dem no fit dey pay almost $4000 American Dollars for rent unless dem be Drug Dealers. Money no dey easy like that, make dem no deceive us. Na all of us sabi say majority of our People wey dey for Oyinbo Country no get that kind money especially since dem go pay rent and mortgage for their Domain. And the people wey I know say go do anything to live for the place na our own Barawos wey we dey call Governors, Senators, Congress and the rest of their Ogbologbo Onyeochi dem. We no say plenty of dem no be say dem get factory for Agbara or Aba wey dey make money for dem. Na this our so call oil money na him dem go take rent the place. And plenty of dem na their young Concubines wey dem fit born na him dem go put for the place.

My people na this kind thing I hope say our Press go write for their papers o. Any politicians wey we hear say he get flat for the place, he no need say make wey probe am or say make wey create panels wey dem go bribe, this na Bar Beach straight tarara, make he go face firing squad for the place. I no want hear tory, this na our money. No person wey get sense go go spend that kind money for Flat when you know say if you times four times na big mansion be that for VGC area. My people na here I go stop o, na beg I dey beg the estate owners say he go good make dem be part of our solution no be part of the problem. Nigeria na awa country, make we treat am well.

December.14.2001

Lagos Lawyers Nawa For Una O

My fellow Obodians how now, I hope this life dey treat una better? I know say plenty of una don hear the hilahilo way happen for Lagos Court last week between Former Chief Security Officer during Abacha regime, Major Hamza Al-Mustapha the man wey dem talk say he dey among people wey want kill Chief Alex Ibru for Lagos along with him lawyer and one Judge, Justice Ade Alabi.

According to my source, them talk am say na the Judge first start the thing. I hear the lawyer for the accused person talk say we want change something for the case and the Judge come talk am say he no go gree. As them dey argue back and forth, na him I hear say the Judge talk say the Lawyer dey behave like he be Hooligan. Na him be say he dey behave like all these "Area boys" wey we dey see for Lagos. The lawyer come ask the Judge say se na him he dey call hooligan, the Judge come say yes. So when the man hear that, he come tell Judge say him go withdraw as Lawyer for the Accused because him no think say he go fit continue with Judge wey no respect am. I hear say the Lawyer too na SAN o, na him be say him no be suegbe (mumu) lawyer. When Al Mustapha hear that he come tell the Judge say him no fit respect am as he dey call his lawyer Hooligan. I hear say the Judge say him no care. Na him Mustapha come let the Judge hear am. He talk say the Judge na yeye and he dey bias agaist am and his Lawyer because dem no be Yoruba. He come ask the Judge say if to say him Lawyer na Yoruba, se he go fit call am Hooligan? My people I hear say Al Mustapha and him lawyer dey vex gan o. He tell the Judge say him get proof say he the man don take bribe from people wey no want make he go free. Dem talk say the Judge ask am make he sit down and the man say no. To cut my tory short the case no fit continue that day o.

But the thing wey make me vex small for the thing be how plenty Lagos Lawyers especially my Yoruba people own dey attack the lawyer wey be Ibo. Dem talk say dem go ask make Lagos state Justice Office punish the lawyer for the thing. My people I no sabi this one o, how many lawyers go take that kind abuse for court? All these Lagos Lawyers wey dey attack the man, I fit bet una my life say if to na dem the Judge call hooligan, I no think say dem go like am and na wrestling the thing go turn to. Dem fit talk say make dem remove the Judge patapata. Make una no get me wrong o, I no like the way wey Al Mustapha dem behave for the court, if fit be true say the man and his lawyer want take cunny cunny dabaru the case as dem dey ask say make dem postpone the thing, but I no think say the thing deserve wey Judge go dey call the lawyer Hooligan. Which kind language be that wey person wey we call Judge go dey do name calling for court. The only problem wey I get with the lawyer be say he for tell his Client make he meshonu (shutup) because na the Judge court dem dey and you no fit dey talk to a Judge like that. But my people, the Judge behaviour for court that dey, dey small to reach o (O Ku die ka to). As Oyinbo people dey talk am that kind talk no belong for court. If to say na me be the Lawyer, na salt I go take wash the Judge mouth for am. I hope say the people wey go look into the matter go dey fair for the thing. We no fit look the other side because one Judge na our friend or from our tribe. No be the lawyer talk say we dey equal under Lawyer, which kind tribal stuff dem want put for the thing? Na everybody no say the accused dey guilty for the trial but since wey no dey there when the thing happen, he go good make we let the people wey dey in charge for the thing do their work. As for the case, I hope the Judge go remove himself because his behaviour for court that day means say he no go fit dey objective. Even self, I hear say Former Chief of Army Staff, Lt. Gen. Ishaya Bamaiyi too talk say the Judge dey ask for money for back. Na him be say the Judge no fit judge the thing well since dem don accuse am say he want take money. The man don let the accussed get to him as he forget his cool. But that one no be excuse, we no fit dey put emotion for court matter. As for Mustapha, he be like say the man still think say na Abacha regime na him dey wey. The man dey pompous and arrogant and he no get respect for anybody. How he go tell a Judge for that matter say him and the Judge no dey for the same class, nawa for our soldier o. For that, make dem add to his sentence if dem find am guilty of the main case. But I still think say make dem just give the case to another Judge, we all know say no matter who dem put, the people na baba nla criminals and dem go find dem guilty for the crime.

Na here I go stop my people, make una tak am jeje o.

November.29.2001

Who dey Make our Sharia Law Self?

Doh my people, how una dey? I hope una dey cope with all these hilahilo wey dey happen for our Obodo Nigeria. Wetin dey happen with my people for North wey be say na one fight after another we dey hear every week? He be like this Sharia thing dey done dey make everybody kolo o. I guess he get as he be for some of us wey dey leave for North. As people no get the kind freedom wey dem get before dem just dey take am on their Neigbhours.

No be yesterday I hear again say there was a fight between my people wey be Cattle rearers some Farmers. Dem talk say na about 9 people lose their life because of some yeye reason wey I no sabi. I beg make all these Panels and committee wey our Government dey create left and right no come tell us say na because of some Malu wey wander into the farmer land o na him make people dey kill. That one go dey low, he go belike say people value Malu life pass their fellow humanbeing. I guess our Leaders dem wey think say Sharia go settle all the ills wey dey for our society now sabi say na only when people get better work and food for table na him dem go think about Religion and Peace for our motherland. All these foreign religion no fit solve am. Na beg I dey beg my fellow country people make dem take am easy o.

Since we dey talk about Sharia self, wetin I dey hear for Sokoto State wey dem talk say one yeye Sharia Judge sentence a small girl for death because she comit adultery with one man wey dey marry. Before I go even talk about the thing, how person wey dey single go comit adultery. I no say I no be lawyer o and my knowledge for School own na Standard Six he end, but one thing wey I sabi be say the na fornication dem dey call the kind thing wey she do, she no fit commit Adultery since she dey single. Make I turn back to the court case, where dem dey get all these Sharia Judges self? He be like say plenty of dem no sabi law, I hope no be some week Sharia Course wey dem learn for Saudi na him dem want dey take dey judge us for our Obodo? The thing wey I no sabi be say which time he become crime say person sleep with another person wey no be him wife or husband? Plenty of all these our yeye Governors wey introduce the thing, how many of dem get one wife? Dem no fit tell me say say the first day wey dem meet their wives na that the same day na him dem marry dem? How many fit tell us for Television say him no have sex with the women dem before he marry dem? Another thing be say, how many of dem want put their hands for Koran say since dem marry their wives dem no touch another woman or even self since dem introduce the so call Religion Law, how many want talk say him never sleep with another woman beside him wives? I don talk am before this Sharia law no only people like me wey poor and no get money go surfer am. Person wey come from rich family and the ones wey get people for high places no dey pay the thing any mind as na poor people law. Since dem talk say the woman go die, why the thing no apply to the person wey sleep with am? I be the girl sleep by herself? I hear dem talk say the yeye Judge no dey hard on the man wey give the girl belle. Who the callous Judge want make he take care the Pikin wey the girl go born? Na wa for our Sharia Judge o, the person wey actually commit the crime go go free why the poor innocent girl go die because she sleep with marry man. No be say dem talk say "he takes two to tango", wetin make the Judge believe say no be by force the man take give the girl Belle as the thing common for our Obodo especially for Village? No be say I support death o, as he be say dem go kill the girl true true, he go good make Human Rights Groups too take the man go court for the same crime for another state as our Sharia Judges for Sokoto don dey kolo. Dem don turn Sharia Law upside down. Where our Federal Government dey for this? Make una no tell me say that our Araoke Attorney General Ige no sabi him left from right o? Why we need dem self if dem no fit defend innocent girl wey be citizen of our Obodo Nigeria. Abi this great force wey dey behind Sharia don make our Federal Government too tremble and dey too afraid to even talk about the thing? If our so call Attorney General no sabi our Constitution make he ask the people wey sabi am well well. I no say Federal Government get power pass State Courts and our Uncle Legba the President too get power if him too along with the yeye Advisers wey just dey chop our money for nothing go read their law book. The reason why we get advisors for Nigeria I no sabi self since plenty of dem no sabi their work. My people no be secret say I no like this dubious Sharia law wey our desperate politicians want take surpress us as dem no fit do the thing wey dem dey do when Khaki Boys dem dey for power. The thing be say na only poor people the thing affect and plus the so call Sharia Judges na joke and dem no sabi their yansh from their back. Se una hear about another Sharia Judge wey sentence one man for murder, and him come talk say the knife wey the man take kill the victim na the say knife dem go take kill am. Where the man get his own law I no sabi, when we no be cow wey dem dey slaughter for Abattoir for Lagos. How dem go take kill the man with knife, se dem go dumbu am abi na wetin? My people he get as he be. These people make me sick. I go dey tak to una now, make una dey do jeje o.

November.21.2001

The Havoc Wey Our Leaders Dem Dey Cause

How una dey my people, I hope say una dey kampe? I know say he don tay wey una hear from me. As una see we don get new look for this our Virtual Booklet wey we call Online Commentary. Na our Oga patapata talk say his money don come make we change the website around. Poku still plenty inside the soup o, the man wan do the thing small small. I beg make I no bore una with our company tory as I know say plenty of una go talk say no be that one una go chop.

My fellow Obodians wetin una think about this security palava wey be say the thing no gree comot our minds. Everywhere you go, na soso Armed Robber talk you go dey hear. I no fit remember the last time wey I close my two eyes when I dey sleep for house. As the yeye Barawos dem no dey separate poor soul like me from those Pen Robbers wey dey their mansion dey chop our money. But truth truth if we look am well well, I no think say our Leaders dem dey serious about the thing as plenty of dem get money wey dem go fit take buy security. And as for these our Politicians from the President down to Council Chairman wey dey for my Mama Village, na so so talk dem just dem talk as the thing no too dey affect dem. Na everytime we dey hear say dem go hire plenty people for Police and come give dem weapons and equipment wey dem go take fight crime.
But my people I no think say that one go fit solve am especially if our Leaders dem no change the way wey dem dey take run our Police Force.

My people make I break the thing down for una small, how many people una think say we get for Police Force and how many Politicians we get for the country? I know say the number go dey close but if una add our Leaders dem family, the number dem go fit fill a whole Lagos State.

All this ngbati ngbati wey these our Leaders dem dey talk say because our Police no get weapon na the reason wey dey make crime rise be that. Even if we give our Police plenty Weapons that one no go solve am as plenty of those weapons go end up for Robbers Hands. Unless our Oga Politicians dem look their backyard first, na Otubante (waste of time and energy) the thing go turn to.

My people if una look the number of our Force wey dey follow our Politicians dem from our Excellency Uncle Sege down to our Honourable Council Man/Woman, that one self fit cover a whole Lagos and some states. And una know say the people get plenty family no be small, we dey talk about our First Lady and their pikin dem. And make we no forget say plenty Council Chairmen/Chairwomen get concubines for corner wey Police dey provide security. And I know say plenty of their friends wey dey live for Obodo Oyinbo too go get Police Escort when dem visit home. So my fellow Obodians, which account we go come right this one o? I no dey talk about one Police man per person o, una know say people like our Governors dem dey get battalion wey dey follow dem and their Dogs. The thing be say as Police Academy dey graduate people na so our Leaders dem dey assign dem for their own selfish reason. Na only for our Obodo you go see Oga Messeger for Governor Office dey get Escort. My brother talk say for America dem, Senator no dey get escort unless he be Senate Leader or Speaker of the House. All the other ones na only dem dey waka about or make their aide follow dem but no be go house o.

But for our Beloved Nigeria, even Politician Dogs get Escort and our Leaders dey talk say Police no too plenty. My people if dem fit comot all those goones wey dey do follow follow behind dem and their family, crime go reduce no be small. This our country we no too dey use our God given Talent for better thing. This kind attitude don dey around for long time and the thing no dey fetch us anything but trouble and destruction. Plenty of our Leaders no be say dem no get sense but GREED and EGO don chop their common sense finish and dem just dey waka like Dead people wey him brain don die pafuka

As I want stop here, if our Leaders continue this their AS USUAL business, our Obodo go continue dey get problem from every corner of our beloved country. I hope dem go look at the mirror first and change their way of live.

OGA POLITICIANS, TAKE A BITE AT CRIME BY RELEASING YOUR ESCORT TO THE COMMMUNITY.

November.02.2001

Wetin Una Do For Us Lately Oga Politicians?

How una dey my fellow Obodians, I hope say una dey kampe? My people I no know for una but me I don tire for these yeye Politicians wey we call our Leaders. As dem no do the thing wey go help move our country forward, I no sabi why we dey pay dem in the first place. No be last year I talk say I no fit see the thing wey dem do wey I go talk say improve the Lives of us wey be Commoners. As this year want end so, I still no sabi the thing wey dem don do for us o. But na everytime we dey hear say dem spend our money for something wey no fit put food for our table.

For example, this our so call Pan Africanism me I no support am now especially when our country dey go down hill. No be say I no like my fellow Africans wey dey for our Continent but as people for my village dey talk am, "if fire dey born us and dey born our pikin if we want save ourselves and the poor pikin, we go first quench the fire wey dey born us before we go comot the one wey dey born our Pikin". Na him be say if you dey drown you must first save yourself before you go fit save another person. Everytime you turn around una go hear say our President dey help some people for other African countries. Another time una go hear say the man dey give free oil to our Neighbours for Niger and Chad. The thing wey I want tell our Big Belle Leaders be say he no mean say because dem family get plenty food eat and plenty money to blow na him be say the rest of us wey be Nigerians no dey go sleep hungry for night. I know say plenty of dem no be say dem born dem with silver spoon for mouth, I hope dem remember say plenty Nigerians dey, wey dey die for hunger as dem no get money feed their family. As the thing be so, I no sabi the progress wey that our Minister for Information dey cry about o. If to say na those two or three caterpillars wey the Government buy for one or two villages for few states na him the man dey call dividend for Democracy make he go check his head for Aro Abeokuta. I go even talk say if the man want hear truth, make he come to our area for Malu Road, he go know say that their cry for democracy dividend na propaganda wey no help us but just dem and their WOBIA FRIENDS AND CRONIES.

My people these our leaders dem no get heart o, una notice say for the past one month na that their yeye Electoral Bill we dey hear for Radio, Television and Newspapers as if to say the world want come to an end. I no kuku sabi the thing wey dem dey force about? Se dem think say we Mekunus care whether some councillors stay for three our four years. Or make some Governors dem allow other people take their posts as dem don serve as Govenors two times already. As my brother for America dey talk- WHO CARES? Se as crime plenty so wey we no fit sleep with both our eyes close for night or wey plenty children don die because of hunger, or the one about plenty of our youths wey don become men and women of underworld as the degree wey dem get don because useless since dem no fit find work with am, or what about our girls dem wey dey sell their body because dem no fit find work do and dem no want turn to Armed Robbers? Nawa o my fellow Obodians, which time wey our so call Leaders dem go put the kind energy wey dem dey put for this their yeye Bill for Project wey go fit solve plenty of those problems wey I talk just now? As for now I not think say we care whether one person be Governor or make another person be deputy, the thing wey dey burn us for under dey serious pass who our next leader go be. Sebi na person wey don belle full go dey worry about that. I beg my people, make we start dey pray and ask our God /Allah say which time HE go bring LEADERS wey go put our country and the people wey dey live for am first before their Bank account for Switzerland? Na only God/Allah fit solve this one for us o, and I hope say we go dey alive to witness am.

Na here I go stop, make una take am easy o. Please LOVE YOUR NEIGBOURS AS YOU LOVE YOURSELF.

October.31.2001

Liers Plenty For Aso Rock

How dey go dey go my fellow countrymen and Women? I don hear another one o. Dem talk say our President Uncle Sege and his Military Leaders dem talk say the thing wey dem talk say happen for Plateau State na lie. Dem talk say no be so the thing happen. When the thing don become embarrasment for dem, na him dem come change their tory. Last Week when President dey talk to our Press him talk say the Soldier wey dey involve for the thing dey defend themselves against the people wey dey atack dem.Weting una expect from an ex-Soldier. Na everybody know say our own Military no get honours. All of dem na Ogbologbo for Lies.

My people this na our President o. The person wey be say for our Constitution dem talk say make he defend us esepecially the ones wey dey unarmed. This na the man wey dey in charge of our Country o. The man wey no fit defend small pikin dem and their mama wey those yeye Drug smoker hoodlums wey call themselves Soldiers yamutu. I still no fit believe the thing o. How person go shoot Women and small pikin and our President go turn around and talk say the soldier dey defend themselves. The question wey our So Call Reporters for ask am be say against who the Khaki Boys dey defend themselves. The thing wey we hear be say them gather men together and come dem shoot dem like say dem be Malu for Ajegunle. I even hear say no be say the people wey dem kill get guns o. If to say na true true the Army dey defend themselves why he no ask the coward Khaki Boys come tell us wey be Public their own side for the tory. If na true true the Army dey defend themselves why we no bring Detectives for Obodo Oyinbo make dem study the thing. We can even ask the man wey defend Simpson during Evidence own for America make he come investigate the thing for us. Se una remember say the first time wey people talk say the thing happen, that our yeye Chief of Staff Ogomudia talk say na lie people dey lie say him Boys no do the thing. I no sabi why the man no fit resign if him be real Professional. Person wey be man of Integrity for don resign since the thing happen under his watch. But make una no expect say that kind thing go happen for our Obodo. I never see person wey get that kind moral and Integrity for Nigeria. Because dem no say na the end of their Power trip be that. Plus na him be say end don come for their Chop money be that. Dem no say if dem comot, dem no go fit thief money from our Reserve be that.

All this tory wey all of dem including the Ministers and our Uncle Sege dey talk no fit solve the thing. If to say na true our President want move the country forward, the first thing wey he for do be say, make him comot all those Leaders wey dey in charge including the yeye Cowards wey kill people wey no get weapons for hand. If to say he fit possible, I for talk say make our President no run for another term as the thing happen during his term. Na that kind action go fit move our country forward and people go respecct am more. Instead of this cock and bull tory wey dem dey tell us as if to say we be mumu.

Na here I go stop my fellow obodians, make una no expect say the people wey give the Order and their Muguns go face Justice for Nigeria. Small time dem go create one yeye Panel talk say make dem Investigate the thing. Wetin happen to all those Panels wey dem create before? No No be say na just talk our Leaders dey talk. Na the same thing go happen to this one. Our Uncle Sege too dey afraid, him know say if he try am na for him house for Egbaland him go find himselve. Dem go overthrow am, his entourage and send dem packing

October.26.2001

Our Soldier Don Turn To Killers

He don happen o my people, our Soldier for Benue don turn our Villages to Killing Fields. No be this week I dey tell una say our Soldier go revenge. I know say na their mama born dem, he no dey hard if you want figure our Khaki Boys out. Why una think say Our Late Yabbist King call dem Zombie? Dem too no dey hear word at all. Na go dem hear as my Grandmother for Village dey talk, dem no dey hear come. I know say dem go make sure say dem teach the people lesson.

My fellow Obodians, una go think say our Soldiers dem go use some common sense get the people wey kill their peers, but no be for our Nigeria, common sense no dey common for the people. Which kind human beings wey no get soul go gather people together like say dem be Malu (cows) and come spray dem with Bullets? Una mean say our Army no be person again wey be say dem no sabi between right and wrong. Una want tell say the money wey our Government dey spend for their head na to kill innocent people dem go learn for training? Haba Alhaji, wetin this world dem turn to wey be say our soldier go just kill people just like that and dem no go blink. You mean say everytime dem wear that yeye Uniform, Evil go just creep into that their small brains? Yamutu people coldblood like say dem be fowl for market? My poeple this one don pass me o, I no sabi this kind thing. Why dem no fit fight their fellow Village Soldiers for Liberia like that? My African Brethrens for the place for dey enjoy their Obodo now, instead na that yeye Monster wey call himself Leader dey use the Obodo like say na him papa Domain. All this gbana wey dem dey smoke don turn their head so tay dem no sabi Human again wey be say anything wey cross their way na yamutu. Se no be person born dem, abi dem no dey shame? Small time dem go call themselves Professional Soldiers, no mind dem, dem be Wannabe Mercenaries wey dey prey on Innocent people. Their sakara na our obodo he reach, dem for send go Afganistan make Talibans teach dem lessons.

As for my fellow Obodians wey no sabi the thing wey I dey talk, make I tell una small. No be for Tuesday I hear for Radio say our Soldier dem pack themselves for Motor come go the area where some yeye youths kill their fellow Soldiers two weeks ago. When dem reach the place, dem come ask the villagers say make dem come outside say dem want talk to dem. As my source tell me, she say dem come separate our men from women and children dem. Na him dem come spray the men with bullets like say na Animals dem dey kill. From their I hear say dem go another village and kill all the men wey dey there too.

Some people even talk say dem go our Former Minister of Defence, General Kalu house and kill Four people for the place. My people make una dey surprise if our country no pafuka soon because I no understand that one. If dem fit go their Oga patapata house go kill him relatives wetin una think say dem go do with me and una? Na him be say this our Country don dey dabaru small small be that. If our President and his people think say everything dey kampe, na him be say if una sabi person wey our Uncle Sege and his Deputies dem, make una tell dem say make dem stop the Ogogoro wey dem dey drink wey make no fit think straight, because our Obodo don dey crack small small. If our country still dey kampe after next election, make una know say no be my Papa born me. All this tory wey dem talk say na Tiv and Jukun people dey fight themselves because dem no want live together again na lie, I know say na some Godfathers push the thing as say dey go benefit from the thing if our Country pafuka.

As I want stop here my fellow Obodians, make una no surprise if una hear say my brother for Obodo America don send for me o. Since our Leaders dem no call me when dem dey chop the money, I no want dey when dem start dey kill themselves. Person wey no eat Giri no dey die suddenly. Make una dey pray for our country o as I go follow my neighbours dem go their Mosque/Church this weekend.

October.22/24.2001

Who Kill Our Soldier for Benue/Taraba State?

My people he don shele again o, I hear say some youths for North go ambush some Soldier and come kill them like say dem be rats. Dem talk say the people wey find the bodies say the way wey dem take kill the Soldier no dey good at all. My source talk say dem kill dem like say dem be animals.

My people which kind wahala wey the yeye youths want start again. I know say no person wey dey for our Obodo wey Soldier never show am pepper. Plenty of us no lilke as the people destroy our Country. Na all of us sabi this. The thing wey those hooligans do to those Soldier na only people wey be monsters go do that kind thing. Plenty of us know say those Khaki Boys wey dem kill no be dem destroy our Country. The people wey do am dey for their mansion dey enjoy our money wey dem thief from our Coffer. On as serious note, the kind thing wey those youths do fit cause wahala for our Obodo o. The thing wey I no sabi be say which kind person or group dey behind this Indian Hemp smokers dem? I no think say those boys fit do that kind thing by themselves. Some powerful people go dey behin the thing. If to na me be Uncle Sege, I go dey careful gan. Some people no too like his government and dem go try all kind thing to dabaru am. I hope say him don send his security men after the invicible power dem. The question wey I want ask be say how those boys fit do that kind thing wey people for the area no go see dem. Something no dey proper for the thing. Even self which kind soldier those people be, wey some youths fit kill all them like that and dem no fit fight back. I no go lie to una, I no care which can weapon person get for hand, if dem waylay me, I go die fighting o. Even if I know say dem plenty pass me, me too go kill plenty of dem before dem before my body become vegetable. That day make God expect plenty visitors because no be only me go go yonder for the thing. But na pray I dey pray make that kind thing no happen to any of us Amen/Amina.

As the thing don happen now, I hope say the people wey sabi the youths wey comit this kind evil deed go come out o if we no want katakata happen for Nigeria. Na all of us know say our Army go take revenge. Before the thing go cause anachy for our Obodo as my brother dey talk, he go good if the killers come out o. If not I pity the next riot wey happen for our Obodo because the Khaki boys go make sure say some people pay for the thing. So my people if una get pikin or family wey too dey involve for riot, make una warn am make he stop am if una no want bury am before his/her time. Na all of us hear and see the thing wey happen for Niger Delta when some youths kill our Security men. And that na against Police o. Una know say our Soldier go come out with full force, like say na Liberia Rebel dem dey fight. I pray say our Leaders dem go resolve the thing before our Country pafuka. Na here I go stop, make una dey do jeje o. Please if una get killers for una midst I beg make una point dem out before innocent people pay for the goods wey dem no get.

October.19.2001

Na wa for our Away President O

How dey go dey go my fellow Obodians, I hope una dey live? Which kind country we dey self my people? Why be say we no get luck for Leader own. If una look our history, plenty of our Past President na yeye. Dem be like Asewo wey be say na because of money she dey sleep with you. Na him be say she no too care how you be. Na that kind person we dey get as Leaders for Nigeria. If dem no thief our money dem go sell our rights to Foreigners. Just like Abacha dem wey go take our money open business for his family for Ivory Coast. You mean say our youths no sabi work. Why dem no fit open company for our Obodo so our youths fit find work do.

But the one wey we get for that position now that one wohwoh small. No be say he thief money (yet) o, na because o his ways. Make una no get me wrong o, I like the man small but the thing wey I no sabi be say the Old man no too dey think at all or him advisors na mumu. The reason be say na everybody wey dey for this world sabi the riot for Kano between Bin Laben relatives for Nigeria and their Christian brethen. Even my brother wey dey for America talk am say he see am for CNN. Na the same thing my cousin for Paris talk. The only people wey I think no hear or see the thing na our Uncle Sege and his wacky and die friends wey he call advisors. Make I ask una this, how person house go dey burn and he go come dey go party? This one pass me o. How wahala go dey for our country and our President go dey go Overseas? His country men dey kill themselves our President dey go Paris go shake hands for people wey he forget shake their hands the last time he travel. Abi na French Food wey dem go serve for the place na him our Leader never chop before and he think say he go miss am? Which award dem want give for the place wey pass innocent people wey dey die for our Obodo? Abi which meeting dem dey do self wey be say him life depend on am. This na our President o and the man want make dem relect am again. We dey hear plenty world leaders wey be say any time wey trouble dey for their country na the end of the trip be that. Plenty Leaders go trade place with our President because na the thing wey dem fit take win Eletion be that. I guess the thing no mean anything for our Obodo as the man know say our votes no dey count. No matter what we do, his people go stuff the ballot boxes.

The man get some nerves o as dem dey talk for America, I even hear say the soldier wey go meet am for Airport the man ignore dem. He no even look their side as if to say dem no dey. This na our country President o. Na everything dey dey akward for our Obodo, I no sabi the thing wey those soldier do wey go make our President ignore dem. This na the kind thing wey we no dey hear for other countries because their opponent go jump over that like Ants wey see sugar for road. And the media no go let the person rest. I guess that one no count for our country because na Autocrademocracy we get for our Ohodo no be Democracy. Our Media stll dey run after money instead of tory wey affect our live. I no go lie to una, as of today o, the man no dey get my vote. His behaviour pass me, na him be say the man no respect our country and the people wey dey live for the place. Na here I go stop my people, na only God fit help us for Nigeria because plenty of our so call leaders na wolf in sheep agbada.

October.17.2001

Haba My Hausa People Dem!

My people how una dey cope with all this nonsense wey dey happen for North. Wetin dey happen for the place self wey be say na every week dem dey kill themselves? The thing wey I go talk today plenty, and I know say my Northern brethren no go like am but nothing go prevent me wey I no go speak truth.

No be for the Oputa panel wey I hear one Major dey talk say our Hausa Leaders put am for Prison because his people carry one market from area wey my Hausa people plenty and come go build new one wey Hausa no plenty. The man talk say na the thing wey cause wahala wey plenty people die for the thing be that. He even talk the hoodlums burn plenty properties. He say small time he found himselve dey look Prison wall. He even talk say for Prison dem no tell am why he dey the place. To cut the tory short the man say dem sentence am and Major General Gumwalk to death. He say na only God save am, wey be say dem come reduce the thing to 5 Years imprisonment. According to the Major, he talk say plenty people wey dem put for Jail na from his tribe, he talk say dem no put any Hausa man for Prison.He even talks say our Federal Government dem give the Hausa Community Plenty money and no kobo touch his tribe hand. That one na one.

Se una remember another riot for Plateau State wey plenty Non Hausa people die for the thing. I hear say that one too na because dem say some people kill one Chief and because of that katakata come start. My source talks say if una see how plenty of my Tiv people dey run helter sketer, una go pity dem. Small time some Hausa from surounding States too join for the tihing. I even hear say apart from people wey die, if una see how dem burn plenty Business and Houses for the thing.

Another one na for Kaduna between my Muslim and Christian Brothers. This na over matter wey I no think say concern us for Nigeria. Dem talk say some Muslim people mostly Hausas dey jump up and down when innocent people die for America. I no sabi this thing o my fellow Obodians. I no care which religion you be, Anybody wey dey happy when plenty people die na monster no be person. Where he dey for Koran wey God say he dey alright make you kill your neighbours? Small time plenty of these my moslem brothers go go Mosque dey pray to God. The people just dey deceive themselves because I no think say God go hear that kind prayer when we dey support destruction of our fellow mankind.

The last one wey I go talk again na the one wey happen for Kano. I hear say some fools dey use the money wey dem earn for work dey buy Bin Laden Memorablia (Mobile Phones, Tshirts, etc). Why be say some of us we no dey use our God given Brain self? This thing too dey happen where our Black people dey. We too dey worship people instead of our Makers. These people wey dey protest against America, which of dem wey that kind thing go happen for his village or Town, he no go carry cutlass go attack people wey kill his family and townsmen. Una want tell me say as America want fight the people wey destroy their lives and Properties no dey justify? I know say plenty of una no forget the thing wey happen for Lagos last year? No be una want carry Trailers go Lagos go attack our Yoruba people because dem kill plenty of my Hausa people for Lagos? Why America no fit do the same thing?

Wetin our Arab brothers do for us self other than say we dey worship the same God? These fools wey dey attack Christians for North, una want tell me say if our Arab brothers dey kill Christians wey be Nigerians una go support dem because dem be fellow Moslems. The way plenty of una dey practice una religion self pass me o. If una no no, All of us wey be Nigerians na black. Plenty of our Arab people na Yellow. Se una hear say plenty of our people wey be black for Sudan, the so call people wey una dey support dey use dem as slaves. These na una fellow black people o. So my fellow Hausa, I know say plenty of us dey nice for bod, na the few Animals weu dey among us dey cause this katakata. But we as people, he go good if we check ourselves, deeds and words. We get plenty Tribes for Nigeria, why be say na only my Hausa people dey fight everybody. As my Mama dey talk when I dey young. Everytime wey she catch me dey fight, I go tell am say na jeje I sit down wey the person come hit me. And my Mama go talk say why be say na the same tory I dey talk everytime she catch me dey fight? She talk say he go good if I look at myself first because different people no fit dey do the same thing to me all the time.

My people na here I go stop o, He go good if we watch our deeds before we cause katakata for our Obodo. This killing don dey dey too much o. If we no stop this self destruction, I no think say the country go fit survive o.

October.10.2001

Nigeria Connection: Our Police Don Become Teachers

My people how dey go dey go, I beg make una no vex with me. I no too dey get tory nowadays. Una don hear this one, I don hear another one o, and una go laugh if una hear am. No be jeje I sit down for Office dey nak tory with some Omoges na him one boy come tell me say I get visitor from Maiduguri. As I reach the place so na my friend Mohammed wey be Oga for Police na him I see. The Man don change o, you no go even know say the man na Olopa as him face fat so. Him no be the kind police wey dey chop corn for roadside for my area. I come ask am wetin he dey do for our area, na him come tell me say him dey here for official business na him make him say make he stop by my house. When he reach my house na him dem tell am say I dey for office. The yeye man with him belle dey ask me how tey get the job self? To cut the tory shot na him the man tell me say him dey go back to Maiduguri tomorrow and I come ask am say no be today he just come and why he dey rush. Na him he come tell me say dem get some training wey dey important. I come ask am say which kind yeye training dem dey do for Police Station wey dey important. Na him the man tell me say the training na for some people from Congo Republic. I come ask am as I dey laugh say if he mean our Olopa go train Police from Congo, and he come say yes. Mohammed come ask me why I dey laugh, my people wetin una think?

No be say I no like our Police ( I no fit talk say I dey proud of dem) but the thing be say dem mean say these Congolese dem no fit find another country Police and na our Nigerian Police Force dem want make he train dem? I no too sabi the country but the thing be say if dem no get checkpoint for Congo before, now dem go get am. Una mean say the people no dey read papers? Abi because dem no sabi English na him make dem no sabi say our Police na Ogbologbo for fraud. Which kind law enforcement dem dem want learn from us when our own too dey go Obodo Oyinbo go learn how to become Police? I hope say no be their country go pay for the thing because the thing go be waste of money. I know Plenty of una no too like the thing wey I dey talk but my people if we no want lie to ourselves our Police na Big Jagudas. You mean our Police wey dey give guns to men of underworld for evening and come collect am for early morning after dem don get their own shares, sabi crime prevention? Why be say na Robbers dey rule our country? I no dey lie if I say our Nigerian Police dey among the worst Olopa for this world. The people wey fit sell their mama because of money go come dey train some African Police. I pity the people for Brazzaville, the little peace wey dem get don pafuka be that. Because I no sabi say our Police Force fit teach dem anything positive since Agbari dey too much for our people. I understand say other people think say we be Giant of Africa and we sabi plenty, that na lie for my book. I know plenty African countries wey better our country fine fine. For Nigeria we dey bless but the problem be say plenty of us dey look for easy money and we no want sweat for the thing. And the leaders dem, those na disgrace. The only thing wey dem sabi na to feed their big belle and waste our money for their concubine heads.

Our Police na reflection of our society, we too like money and we dey corrupt. Na everything get price for our obodo including our conscience. Na here I go stop my people, if to say the young Kabila ask for my opinion I for tell am say make he no waste his money. The people wey he send go dey worst pass before dem come Nigeria.

October.01.2001

Nigeria Saga: Murder For Hire

My fellow Obodians life don tire me for this our Country o. As I see am, life no mean anything for our Obodo. People just dey die like fly and the Police no fit do anything about am. And the problem be say our Police no want talk say dem don fail us. How many times una hear say our Police catch someone for murder. Even ordinary Armed Robbers wey be our Number One Enemy dem don become Kings of our Land. What a joke. The only people wey dem fit catch na OPC and Bakassi Boys dem because those dey easy for dem. The ones wey no get face like the Hired Killers just dey operate like say we no get security for our Obodo.

This Assasin palava self how the thing take start self? My people why be say for our Obodo we no too dey copy Oyinbo behaviour wey go do our country good? Na the one wey fit wipe our whole country na him we go dey follow follow like people wey no get direction. Make we take asewo own for example. If you go Allen Avenue and Ajegunle na so you go see our women dem with skimpy skirt like say na their junior sister wrapper dem wear. Some of dem be like masqurade wey dey for my papa village. And this kind corner thing wey these yeye girls dem dey do no be kind thing wey our forefathers pass down to us o.. But as country hard so na everybody dem dey sell her body for money. Sebi na the one wey dey for corner we dey, plenty asewo poku for Corporate world own. Na dem dem dey call Senior Girls. These na the women wey you go see dey run after bank managers and Managing Directors. All these thing don make our women cheap. Sebi una hear about our pikin dem wey don become Body snatcher for Europe. This na the kind thing wey our Leaders don turn our people into be that o. But this one small compare to this Assasin palava my people.

The major problem na this Hired Killer own. As he be for our Obodo now, no person life safe. Se una hear about Mr Monday Ndor, member of River State House Assembly wey assasin kill as the man dey return from Bori Town. This no be first this year o. Plenty Politicians and Business men and women don die from this Undesirable Elements and I no think say I ever hear say our Police catch one Killer for the crime. Plenty of dem na Egunje (bribe) you go see dem dey collect for check point from Danfo and Molue drivers. The reason why we still get Police self for Nigeria I no sabi. I know say the thing no dey easy but the way wey things dey go, this people go continue dey kill us like rats unless our Police do something about it. Our Leaders dem wey dey call Oyinbo people make dem come invest for Nigeria just dey waste their time. Se our people wey be say if you do business with dem finish when the time come make you collect your own share na Hired Assasin dem go send after you make dem come kill you for Hotel. If to say I be Oyinbo wey get money, I no go lie to una my fellow Obodians, our Obodo go be the last place wey I want do business. Agbari don dey too much for our Obodo, and the thing don dey deadly as our Business people don start another way wey dem go fit comot their partners. Before na through Juju, but plenty of dem don go hightech now. Before you know it, na Hired Killer go dey pursuit person everywhere you go. Person life no worth penny for our Obodo now.

Twenty years ago this kind thing no dey for our Obodo. But as soon as this General Marodonna Babangida enter power, our life just change for worse. No crime wey no dey for Nigeria now. Some crime before na inside movie you go dey see dem. Plenty of dem don get root for Nigeria now. And our Leaders no fit do anything as plenty of dem dey among the people wey dey comit all these attocities wey don become disease for Nigeria. The baba Isale (Kingpin) for the thing na our so call Leaders. I don tell my friends and families wey get small money say if dem value their lives make dem no join politics or do business with our people dem. If dem want start business wey dem no get all the money make dem just leave the money for bank. Although that one too no safe as our Bank Managers and Cashiers don become informants for men of Underworld. Na wa for our country no place even safe o.

As I want stop here the thing wey I go say be say as Police dem don loose control for the thing, he go good make everybody for Nigeria dey carry gun. I know say this no be best idea but at least before person attack you, him go think twice as he sabi say you get your own gun too. All these Barawos wey dey attack in large numbers when dem want attack a whole Estate go think before dem come because dem know say the thing go be real battle for dem, and dem fit no make am back alive. My people make una just dey pray o because na the only thing wey fit comot us from all these bondage be that.

September.24-26.2001

My people I hope say una no vex as una no hear from me since last week. Thing be say my source dem no fit find tory for me. I dey pray say something go come up this Friday if not we go just dey look ourselves for face ( I just dey joke with una). Any way sa if dem no fit find me tory he be like say I go ask some of una make una tell me something wey una think say go be better topic for our people. Make una wait, he be like say I dey hear one of dem dey enter come. He be like say tory don shele o, I go see una on Friday as my God/Allah don talk am make una dey take am jeje o.

September.21.2001

Uncle Sege Adviser For Aviation Matter Get Big Mouth

My people I don come again o, how una dey? I hope say una dey kampe? Make una no worry he go better one day sa.

He don happen o, I no sabi where our President dey get these him Advisers from self. Before I start, make I tell una why I talk so. Na all of una sabi the thing wey happen to our Friends for America, the God's own country. Plenty people die for the thing and I hear say if una see how many people go lose their job because of the thing una go say Osanobua. Na that we dey talk for our house House before my friend Johnny enter. He come ask me If I don hear the thing wey our President Advisor for Aviation Matters talk? Me I think say he dey talk about that woman wey dem say don dabaru Nigerian Airways, I come ask am say wey thing the woman do again? Na him talk say no be the woman, this person na the adviser no be Minister. As my friend narrate the thing to me, him talk say he read am for News say the man Captain Shehu Usman Iyal talk say the thing wey happen for American Embassies for Tanzania and Kenya no fit happen for here. My people, na so I open my mouth gbaga like this, as if to say no be the thing I hear be that, which kind fools we get for Government self? This na the person wey dey advise our President for Aviation matter o. My fellow Obodians, if una get family wey be Ajala travel make una tell am say the time don come wey he must sit his yansh for one place.

Una see this kind person I no sabi how dem take make am Captain self? Una go think say because na Airforce person he go get some sense for that him small head but he be like say no be so. If to say na Civilian like me wey talk am, we for say na because I no sabi anything na him make talk like that. This person come be captain again, how he tay reach that post self because he no be like say get sense for upstairs. Even America wey be Oga for Technology own and security, na all of us see the thing wey dem do dem. Israel nko, no be almost everyday suicide bombers dey attack their territory? We for ask the man say which kind Ogogoro wey he drink when him talk am? If the thing fit happen to those countries wey I mention, who we be for Nigeria? Make I start with that Captain self. I no go lie to una, if dem bribe the man say make he allow dem make dem attack our Country, the man no go resist. Plenty of our people go sell Nigeria and dem no go blink dem eyes at all at all. Una want tell me say Abacha and all the so call Leaders wey chop our money, dem no be Nigerians? Abi the captain want tell me say those Barawos dem no sabi the thing wey go happen to our Obodo if dem neglet am and send the money to their accounts for Obod Oyinbo? That worst pass terrorist self because na the whole country dey surfer for years. Where plenty of dem dey today? No be dem don become Ministers and Senators wey dey rule us? The thing wey I sabi about our people be say we no get conscience. Plenty Nigerians go sell the country for Kobo and dem no go think twice about.

Another thing be say the thing wey the man talk dey dangerous. Se the man want make those people target our Obodo? As the world dey close so, wetin make the man think say dem no dey among us already? Who go stop dem self? Make una no tell me say these our security men wey be say when dem see ordinary Robbers wey carry Shakabula (local guns) na run dem dey run. You mean na dem go stop person wey get bomb for motor? He be like the man don kolo. I no talk say I be expert o, but I no think say person with that kind background go dey talk that nonsense. Wetin go happen if those people think say we dey deer dem and come face us? As dem never face our country he dey good so. Because those people no be mumu for the thing o. Countries wey get better security pass us dem no fit catch dem and the man come dey talk about us wey be say we no fit stop even Ghana must go back bags wey dey obvious for our Borders. Se the man think say if dem dey carry contraband come our Borders our custom go fit stop dem? He be like say the man no sabi our country self. Se those custom people wey be say na the thing wey dem want chop na him dem dey look for ports. Dem go just give dem some Pounds and our custom officials go look another way.

My people na hear I go stop, I hope say our President go want these his so call Advisers dem make dem dey think before dem open that their big mouths. As for this man, this thing wey he talk dey dangerous and he fit give some people false hope. I hope our President go sack am. Make una dey do jeje o....................

September.19.2001

I Forsee Big Religious War For Our Obodo

My people how una dey, I hope una dey cope with all this hulahula wey dey happen for our World? Na beg I beg una make una forgive me say una no hear from me, na all these killings wey dey happen for our Obodo and America make me no fit come work o. My people I no know for una o, but the way wey things dey happen for our Obodo lately, make una no surprise if hear break lose for Nigeria and war come happen. As for una wey witness civil war of 1966-1967, if una look at the thing wey dey crop unto our society now una go see say dem dey similar. The thing wey I no sabi be say our so call Leaders wey be say plenty of dem participate for last civil war dey act like say dem no sabi the thing wey our people face especially my people wey dey for East. This thing no be joking matter, plenty people lose their lives for the thing. The first sign wey I see, and I believe say our Government make big mistake when dem allow some States make dem introduce Sharia as state law and religion. If we sabi our people well well, we be what some people wey sabi book go call Nomadics. Na him be say we too no dey sit down for one place, we like dey waka waka. If you go North, una go see plenty Southerners wey majority of dem na Christians dey live for the place. And the same thing for South, wey be say plenty Northerners wey be Moslems call the place their home. So the thing wey I no sabi be say why our Leaders dem go allow Sharia Law wey fit divide our country? Wetin our so call SSS dem do wey dem no fit advice our President say that na bad move. Una want tell me say we no get Organization/Agency wey dey in charge of that kind thing for Nigeria? Me and una know say that no be true, because plenty of the people wey rule us in the past, use the thing to oppress their opponents and our people. This na the kind thing wey make our country yeye. The system wey our Colonial Ruler put in place for us wey our government for they use for Intelligence gathering, find out where trouble dey or go fit dey; but our Leaders dey use am dey harrass their opponents. Make I break it for una small small.

This Sharia na good thing for Islam and we fit use am for plenty goods for our Obodo but the thing be say our Country no be like other country, the people wey introduce am no do am because dem be good Muslim. Me I no care the thing wey dem talk, if dem search their mind dem no say plenty of dem do thing for Politics and want use am create katakata for our Obodo. Una want tell me say dem no sabi say the thing go fit cause palavar for our country? And after one state introduce am, the other ones come dey follow follow and the thing come spread like say na bush fire. Plenty of our so call Leaders no get backbones, dem go use anything to remain in power. Dem fit sell their mama if the thing go make dem retain power. This dey typical of our people. Na the same problem we get for craft or job own. Una remember about 10years ago wey be say na everybody want become Fashion Designer, na the same thing dey happen wey be say every where you go, na so so Church and Business Centers you go see for corner. Our people too dey look at another man life dey judge their own. And the thing dey cause plenty wahala pass anything. Why our Uncle Sege go allow the thing dey beyond me o my people. But as I don talk before, the man don change, I no care the thing wey he dey tell us for public. We all know say the man no be mumu and he dey intelligent proper but the problem be say the man na Figure Head. Na "some power that be" dem dey call the short, I no dey wrong if I say dem get something on am. Because I no sabi a sensible Leader wey go allow the kind system wey him and everybody wey dey around am know say na bad omen for our Obodo.

Since the time wey dem make this Sharia state religion and law for our Nigeria na him the thing don dey cause wahala. Plenty innocent people don die as our people dey poor so, plenty of dem lose lose theri properties for the sake of Religion. Last year na Kaduna, Enugu, Anambra, Kano, Zamfara, Ogun, Lagos, Sokoto. This year na Kaduna, Plateau, Cross Rivers, Nasarawa, Bauchi, Plateau, Abia, Anambra, Akwa-Ibom, Kwara, Lagos and some other states wey I no remember. Before we no too dey hear that katakata for our Obodo but now the thing don become routine for our Society. And another thing be say some our so call Leaders wey no fit close their yeye mouth and keep their unwanted opinion to themselves dey fuel this war just because dem want be Relevant at all cost.

As I see am, the thing go happen again, and make una no surprise if the thing lead to Religious war for our Obodo. And if that happen, make una just forget the country wey una sabi as Nigeria. As I want stop now, na beg I dey beg our Leaders including the Imams, Alfa, Cardinal, Pastor, Reverend, Jujuman and Babalawo say make we begin dey talk among ourselves if we no want our country become Yugoslavia. I go see una on Friday as my God don talk am, make una dey do jeje o.

September.12.2001

How una dey my people, I no go fit give talk today because plenty of our co-workers dey live for Obodo America. According to our Oga for Lagos, some of dem na New York City dem dey live. We pray say everybody dey kampe o including other Americans wey the thing affect. I promise una say una go hear from me on Friday. Make una help us pray for dem o.

September.10.2001

No Respect For Our Leaders

How dey go dey go my people, I hope say una dey enjoy o? My people I don find out why Oyinbo dey live longer pass us o. This leave wey I take na him make me realize the thing. Una remember I tell una say I dey go my village go rest. When I reach the place I make sure say my family for Lagos no sabi the place wey I dey stay. Since I don dey go leave na this one I go say I enjoy pass. My people make I no lie to una, life no dey for city o, na for village be the bomb as my brother for America dem talk. Na so so fresh food I dey put for my belle, no be the kind Oku Eko wey plenty people for Lagos dey eat. If una see me now, una go think say I just come back from Obodo Oyinbo. Even people wey dey for our office talk say I look better, but make I no bore una with my enjoyment.

Which kind yeye thing wey I dey hear now wey plenty people talk say make we respect our Leaders especially our Head of States? He be like say the people wey dey talk this nonsense don smoke gbana. Which African Leaders wey una sabi wey put his people welfare before his own? Since wey dem born me na only few people dem na him deseve that kind treatment and plenty of dem don die. Na only General Gowon deserve my respect. No be say the man and his cabinets no chop money but plenty bridge wey una dey waka everyday na him build dem. Even all these monumental buildings wey una see throughout Nigeria especially for Lagos na during the man era na him dem build am. All the other ones from our Current President Uncle Sege to General Abubakar na rogues dem be. Una want tell me say that yeye farm wey our President get for Ota na his own sweat na him take build am? If we look well well na that our money wey dem allocate for OFN (Operation Feed the Nation) na there plenty of the money be.

As for the rest of dem una sabi their stories. Plenty money wey Babangida, Aikhomu, Shagari, Diya, Abacha, Ekwueme and the rest of dem get today belong to all of us. Na the reason wey me no consider dem say dem get money. The place where dem born me, if na true wayo you take get money people no dey respect you. I no respect any of dem. Which time wey una hear say dem take people wey call dem barawos go court? Because the salary wey dem get for their military career as Oga for Soldier no fit reach the kind Billion wey dem stack for Obodo Oyinbo. And as for the civillians among dem, which kind business dem get wey pay dem the kind money wey dem get for Bank accounts now? My people make we no deceive ourselves, all these people wey dey act like say dem born dem with silver spoon na big Onyeochis. Una don see the kind mansions wey dem get around the country, which kind industry una hear say dem get wey dey bring that kind money? I look around our Obodo, I no see or hear say any of these undesirable Elements get company for their village.

So my people, I never see leaders wey dem say make we respect o. Una want make we respect all these people wey be say na through force dem take gain power? Abi the ones wey be say their hands soil with plenty innocent people blood wey dem don send to their maker before their time? So which leaders we dey talk o my people? Make una look around, una want tell me say with all the resources wey we get for our Obodo, how come plenty of our people dem want run go Obodo Oyinbo go live? When I be small pikin, plenty people wey dey go Oyinbo Country go study dey rush back home when dem finish their study, but the thing no be so now. As other countries dem dey move forward, na back and reverse our country dey do. How many middle class we get now and how many dey 25 years ago? Almost all of us now no fit afford three square meals a day. But if una go our leaders dem house, una go think say na everyday be celebration. If una go London, una go see as plenty of their pikin dem dey blow our money like say dem get atlantic ocean for backyard and na money full am.

So my people, as for me o, we no get Leaders wey I go fit respect. Na only Robbers wey dey wear Leader Clothes na him we get for Africa. Na here I go stop my people, make una dey do jeje o.

August.31.2001

Assasin Palava Don Enter Politics

My people I beg make una no vex with me say una no see me on Wednesday. Se a month ago I tell my Oga say I dey go leave. I no sabi say the man think na next week I go begin. Na jeje I sit down for house dey drink Palmwine na him our messenger for work knock for my door say Oga say make he come call me. Me I think say the bobo dey joke since me and an na friends. Na him de man tell me say he wish say na joke him dey joke o, the bobo come talk say our Oga dey vex say I don begin make I no dey dey punctual for work. To cut the tory shot una believe say the man no talk say him no sack me if to say no be our secretary wey show am my leave paper. Any way sa my people, una Senator of the Masses dey go vacation next week Monday as my Oga give me extra day because the man with him Moustache disturb me from my vacation wey I for start this week. I don plan say this time around, na for our village I go run to. Make the man with him big stomach come tell his goonies make dem come call me for village. I no think say the man sabi be say na me be Mayor for our Village. Na kobko na him I go say make dem take comot him wire moustache. Me no fit wait go the place go eat fresh Ogbona and crayfish and I go come nack better palmwine on top of am.

Kedu ko du my people? Se una don hear say war want start for Ebonyi State between our brothers dem Senate President Anyim and Governor Egwu. The kind palava wey begin between these powerful men no be joke. I hear last week say our Senate President Anyim send report to Police say our Governor Dr. Egwu dey threaten am with Assassin. He talk say him don notice say Hire Killer dey follow am here and there. He even talk say the people dey call him house say if him come to Ebonyi, na him dead body him family go carry. Last week I hear say our former Vice President elder Ekwueme and some elders for South East gather together say make dem resolve the thing wey dey between these foolish men. But according to my source for South East, dem talk say Governor Egwu no want settle the thing. Dem say the man no dey happy as dem make Senator Anyim Senate President. I even hear say the man campaign against his fellow Ebonyian for National Assembly. Some people talk say the Governor no dey happy say our Senate President go dey share limelight with am for Ebonyi State. But my people since I no dey there and no be say both of dem call me dey tell me the thing I no sabi if this na true true or not. But my fellow Obodians, if to say na true this people want kill each other because of power, na him be say dem go better thing for us be that for Nigeria. The thing wey I no sabi with dem be say plenty Nigerians go sell their mama if the thing go make dem reach the kind power and prestige wey these too foolish men get. One na Senate President and the other na Governor and dem want kill themselves for the thing, how many of dem wey him family don reach that kind positions before? Na him be say some people no sabi when God lift dem up. Which among dem think say if the other person die, no be him we go blame. Una see my people, these people no be people like me and una o, these na people wey sabi book well well and dem go Univeristy. One na Doctor and the other one he be like say him be Lawyer or Engineer. If to say people like me wey no sabi book dey behave like this, people go tallk say na because we no get education na him dey make us dey behave like bush people. Wetin una go come say about these fools now? If both of dem know say dem too dey big for the position wey we put dem, make dem just comot the thing and let people wey go appreciate dem get the thing.

I don tire for this kind village politics wey plenty of our so call leaders dey practice, if dem no want the thing make dem just comot. Abi na by force? I no sabi the kind unversity wey some of dem go wey be say na through force dem dey take power. These positions dem no be their rights, na priveledge and small time their time go pass. I hope say dem go listen to our Elders and end this chicken fight wey dem want turn deadly.

Na here I go stop my people, I go see una for September 10. Make una dey do jeje o.

August.27.2001

Our Educational System Dey Kill Our Future

My people he no dey easy for person wey be student for our Obodo. This no be the kind thing wey una no sabi. Plenty of una wey go Secondary for Nigeria know say to pass WAEC and GCE no be joke. You go study so tey he go be like say your life want end for the thing. Before I start dey talk about the thing make I start from when person dey for form One. If I miss anything make una forgive me as una sabi say for na Standard Six me I stop since this Book brain no be all of us collect am when we dey come for this world.

When you want comot Primary School, you no fit wait because you know say the next step na Secondary School. And na dat go tell your Family say you no be small pikin again. And plenty of una no want stay home go Secondary because your Family especially your Parents no go let you rest as dem dey ask you make you do this and make you do dat. The day you leave home go Boarding House na dat day you start dey become real man or woman. Because na there dem go teach you home training if you no get one before you comot for your house. The yeye people wey call themselves your Seniors go use you so tey he go be like say na House Boy/Girl you be. Even from the thing wey my nephew tell me, house maid get better life pass you. All the provisions wey your Mama buy you na inside Senior belle the thing go end. You wey be say your brother or sister no fit ask you make you help am watch him trouser and Blouse before you tell am where him/her go go. You cause am so tey he go be like say na you and him/her na mate. But for Boarding school if you try am, na you and Belt go become one as dem go take am put mark for your body. Small time you too become Senior, and everything wey dem do you, you too want do am to people wey be your junior. You don forget the hate wey you get for your Seniors dem when dem make your life miserable. The question wey I want ask be say since you sabi say plenty of the thing wey those Senior do you na injustice why you come do the same thing to the Innocent pikin wey be your Junior for School? Plenty of una go talk say dem dey train person for Future, that fit be true if dem no kill you first.

As you reach Form Five, plenty of una study well well to reach the place. When time don dey reach wey you go graduate, dem give una Mock Test before una do WAEC. Plenty of una do well because una read well well. I hear say plenty schools dey follow WAEC style during this Mock Exam as dem want make their students know how WAEC be. When WAEC come una study hard because everybody know say if you want go University you must get better result for WAEC if not, you go retake the thing or do GCE. Na everybody sabi say the thing no dey easy. Small time when result comot, those yeye WAEC go tell plenty of our pikin say dem fail. And true true if una look am, plenty of those students no be say dem no sabi book but because our Educators dem too dey rely on exam wey person do for one day. As I dumb so I know say some Pikin dey sick for that day, some of dem because hungry no gree den, dem no fit do the thing as hungry no let dem rest. And plenty wey dey live for Big cities like Lagos and Ibadan, no fit reach the Exam place intime because of go slow. This thing don spoil plenty pikin life especially the ones from poor family. Plenty Student wey no get money for another exam, go start dey look for work. But today wey even University graduates no fit find work, na him be say person wey stop for Secodary go end up for him Papa Farm for village if him no want Messenger work for Office.

So my people na so life be for Nigeria o. Thet thing wey I no sabi be say why we too dey make life hard for ourselves especially our Pikin dem? Small time some students we go tell dem say because dem no get all their papers make dem go repeat am or make dem do GCE. Plenty time, plenty of these pikin dem go fail the paper wey dem don get for WAEC and come pass the ones wey dem fail for WAEC. I know sabi why we no fit let dem join am together make dem take enter University, instead we go tell dem make dem go do am again. And this no be exam wey dem dey do every month o, if dem fail am, na another year be that. You go see some people wey don dey take the thing before dem born my mama. Why this hassle self? Plenty of these our Leaders sabi how the thing be when dem be small Pikin o. But the money wey dem dey chop no let dem use their head say make dem change am. And dem know say the thing don destroy plenty of our Pikin wey for don do better thing for our Obodo. You go Oyinbo country, dem dey do things wey go make their Youths wey be their future better, but that no be so for Nigeria. Nothing wey we dey improve, as we dey do things when I be small pikin na so he still be.

The question wey I want ask our so call Expert for Education be say why plenty of our Pikin wey dey go Obodo Oyinbo with Grade Three or no school Cert dey come back as Doctors and Lawyers? And plenty times the kind law and Medicine wey dem sabi better pass our Nigerian Lawyers/Doctors dem. So una see my People, exam wey person do for one day no fit give true test say person sabi the thing or not. Our Pikin dem wey dey study for Obodo Oyinbo don proof that wrong. I hope say our Educators and Leaders dem go change for the sake our Pikin before GIANT WAEC and GCE GO DESTROY THEIR LIFE.

Na here I go stop my people, make una think before una do am o

August.24.2001

Haba Money Grubbers, Una Don Start Again?

How una my fellow Obodians, Se dey go dey go for una? Una don hear? Our Leaders dem especially the Governors don begin their yeye wobia way again. Dem no too dey see money for face. Na everbody sabi say because of plenty oil wey our country sell this year, the money wey dey for our Nigeria Reserve plenty well well. Two weeks ago our Governors dem come decide say dem go take Federal government go court. Dem talk say since the country get plenty money for reserve, make the government share am among all the states. The thing wey dem do in the past wey IMF and other Foreign Banks talk say our Country owe Billions of Dollars na him these wacky and die want start again. I come hear say Uncle Sege and his people wey dey for Federal talk say dem no go share the money as say the country still dey go through some growing pain as dem put am. When I hear that, I tell my friend Johnny say at least some people get some senses for their head for Abuja. No be these Kalokalo wey call themselves Governors wey be say anything wey look like money dem want chop am. Una mean say these people no sabi the say say "make person save for raining day"? And as my Mama people dey talk, NO TAKE YOUR TEN FINGERS CHOP! I come think say as Obasanjo and Central Bank don yari, the thing go stop, but that na dream for my part.

On Monday as I sit down jeje for my house na him my Johnny come stop by my house. He come say he hear say as pressure dem too much for Obasanjo head, the man come agree say Federal Government go share the money. Una see my people, all the yeye people wey we call Leaders na the same side all of dem face. As una know, our President no dey things without a reason. I fit bet una say the Governors dem and their Cronies don threat the man say if he want win another election, make he release the money.

Nawa o my people, these people go continue to eat our country dry like this? Where all these yeye people wey call themselves Human Rights Organization including our so call Media wey be say na Contract their CEO dey look for for Abuja and State Capitals dey? Which people go come fight for our future as all the Elders dem don sell their soul for Naira? Where all these student Leaders dey self? Una want tell me say na only few of us care enough about our Children. My people if una no sabi, na our pikin future na him these people dey mortgage. Upon all the money wey Federal Government allocate to our Governors, I no sabi the thing wey dem take the money do for our Obodo. Instead plenty of dem don share the money among themselves and their cronies. This one no be lie o, I hear say plenty of our Leaders dem especially the Governors dey buy properties yanfu yanfu for Obodo Oyinbo as if to say tomorrow no dey. My source tell me say some Governors dem dey build mansions for Washington Potomac, Chicago, Atlanta and some other cities for America. My source tell me say there is this HighRise Condominum for Washington DC wey plenty rich people dey buy. Dem talk say na only our People dem dey pay cash for the thing. These na flats wey each one cost at least 1 Million Dollars (1.25 Billion Naira). Se una dey hear my fellow obodians?

My people na so una see am, I even hear say Governor for Central Bank talk say him no support the thing o. This na person wey sabi our Economy well well. The man talk say the thing go cause super Inflation for our Obodo but our Government dem no want hear that since plenty of dem sabi where the money dey go. For example make I ask una this question, no be here una dey wey our Comrade Governor Tiunbu borrow plenty money last year, the man don borrow another one again o. Which person wey una think go pay that one when the Governor don comot? Na me and una pikin go dey responsible. While the man and his family go dey chop our KUDI for Washington DC.

As I want stop here my people, I hope say some people wey get small good inside their body for Nigeria go resist this yeye Federal Government bonus wey be say na our Politicians dem dey benefit for the money. I don talk before, if God give me small money, all these Foreign Instituitions na dem I go suit for Wordl Court. Small time dem go talk say our Country owe money, una want tell me say with all the Technology wey dem get, dem no fit go after the people wey wack the money? All these things na politics, these country wey dey borrow us money, na there our so call Leaders wey be Traitors dey store the money. Na the thing wey make Westerners look other side be that because the thing dey help their economy no our own Nigeria.

The thing wey I go say be say, all the people wey dey chop the money make dem continue, one day our Almighty God/Allah go bring person wey go deal with all of dem.

August.22.2001

General President Obasanjo Na Wa o

My people he don shele again o. This one happen for Murtala International Airport. I hear from my source say State Security Service (SSS) no allow our former Vice President Aikhomu go London last Monday. Dem say na jeje the man dey go, as he enter Airport make he go give his Passport to Immigration make dem check am, na him One State Security Service man tell am say he no fit go. The man come call his Oga for Phone about the thing, na him dem tell am make he tell our ex Vice President say President Obasanjo talk say he no fit comot the country. My people make una hear me o, I say dem talk say our General Uncle Sege talk say the man no fit leave our Obodo go London.

Which kind yeye thing wey our Country one start again wey person no fit comot him country because he no support our President? I for understand if the man kill person or steal some money and he want come run away. Dem talk say the man no fit comot because he dey involve for some wahala wey happen for Edo State. The question be say even if the man dey involve, Where our Police dey when all these things dey happen? Dem want tell me say our Police no sabi their job again? I know say I no sabi law well well, but the thing be say wetin concern the State Security Service for the thing? Se our General President and his Security Operatives want tell me say we no get court wey go fit handle something like that? My people, na the thing wey I dey talk about all these Khaki Boys wey dey call themselves Politicians. That their yeye military behaviour still dey for their body. The thing wey I no sabi for these people be say, na dem suppose to sabi law pass, but no be so, na dem dey break am pass. Any time wey things no go their way na him that their were (craze) go come out. Dem too dey think say the world revolve around dem too much. This na lesson to all of una wey dey vote for Ex Military Leaders because dem carry bag of Gari and Rice give una. Plenty of dem too dey behave like say dem don smoke Ganja. I hope say our next President no go dey use him power when things no go his way. As for me o, I do talk say I no go ever vote for person wey be Soldier before, plenty of dem no get respect for their fellow humanbeings. No be lie I dey lie, if to say no be Gun and Boot wey dem dey wear, I fit take plenty of dem one by one.

With all their sakara, na only civilian dem fit handle. Why dem no fit win the war for Sierra Leone when dem face people wey get guns like dem? Na only for Nigeria their power reach, when dem see people wey dey tough pass dem, dem go run away.

Na here I go stop my people, I hope this kind thing wey our yeye SSS and President Obansanjo do no go happen again if our country go move forward. If to say na me be Aikhomu, na court I go carry dem go. But if we think again, that man wey call himself Aikhomu no be better person. The man dey reap the thing wey he sow. The man too don comit plenty attrocities to plenty Nigerians when he dey for power as No 2 Citizen. I don talk am before, na NEMESIS, everybody go get his own. Na the reason be say make we dey do good everytime be that. No person sabi tomorrow. Se Aikhomu sabi say this kind humilation go happen to am? No, na so he be o my fellow Obodians.

August.20.2001

Our Country No Go Better Until...

How una be my fellow Obodians, I hope una dey Kampe? Today the thing wey I want tell una dey serious gan, and want make una think about am well well. This thing dey before dem born me and he still dey as I dey talk to una. Situation for our Obodo no go change unless we change our lifestyle for this country wey all of us call our Papa Land.

The first question wey I want ask una be say how many of una wey dey live for Nigeria no dey work for Government? My people if to say I fit see una I go see say na only few go fit raise their hands. Because for Nigeria plenty of us wey comot school no dey think say make we open our own business. Instead na where we go fit thief plenty money na him we go dey plan. Na everybody sabi say Government no dey pay good money, if want big salary, either you work for Bank or Oil Company. But since that kind job no plenty, the next best thing na Ministry. No be say dem dey pay plenty money but we know say we go dey command plenty respect especially if na better Ministry we dey work. In other words for Ministry you fit become Millionaire if you dey work where plenty contract dey . Na there you go see Messengers wey get plenty houses for Lagos. This na our mentality for Obodo Nigeria, plenty people no join Ministry because dem want help the Country, na how dem go take thief money na him be the motor wey dey drive everybody for the place. From ordinary Messenger to Permanent Secretary, na how much cut dem go get for that contract na him dem dey run after.

The next question be who be the largest Employer for Nigeria? Na all of us know say na our Government. Instead wey our Leaders go create environment where people go fit open their own business, na to steal the money na him be their goals. The money wey dem allocate for Ministry wey go bring investors come our Obodo, the Leaders dem don send the thing to their Bank Account for Zurich. Because of this, work wey dey around no dey plenty. As goverment want reduce unemployment, dem go be force to hire people wey dem no need or want. Small time you see people wey their names dey for payroll but dem no sabi where the Ministry gate dey. As order come from Oga patapata make dem hire plenty people, the Director for Personell don see that as opportunity wey he go fit thief money. The man go create plenty ghost workers as him too want become millionaire. Na this kind thing dey make people dey rush after Government work be that. Our Government dey too big. The money wey dem for use to promote investment, na him dem go use pay ghost workers.

As for the few ones wey get their own business, plenty of dem their business dey evolve goverment Contract. Na everybody for Nigeria be General Contractors. People no dey open business for nothing for our obodo. As soon as you hear say their friends or brothers don become senators or Ministers, kia kia, all of dem don become Contractors because dem know say Ije (food) don dey for dem be that. Na for Nigeria you go see people wey no sabi Medicine but because of their Connection, dem go win Contract wey say make dem supply Medical Equipment to all General Hospitals for our Obodo. How people no go die when everybody don sell their soul to Mighty NAIRA? People wey open business do am for one reason, to thief money from our Government. Everywhere you go na the same tory. People go do everything to become Important for our Society. We believe for Nigeria say the only way wey you go make am for business for Obodo be say our na our Government be your Customer. Na there you go get contract, chop the money and no one go ask you why you no fit the project. Plenty Housing Estates wey una see wey look like places wey dem dey keep Chicken, the contractor don chop the money. And there is nothing our government fit do since the Government people behind am no get clean hands for the thing.

Na all these things dey cause wahala for our Obodo. Since our Government dey encourage am, how una think people go change? Which time wey una see wey wey get good Government?

As I talk before, the only thing wey go make our country better be say our Goverment must change. All this yeye thing wey be say everybody na Government dem dey rely on must change. I dey beg our Leaders say make dem make Ministry hard for all our people wey be say people no go dey rely on am to survive. If Ministry or Government job no dey attractive, that go make people start their own business. Na all those things fit turn our country around. As for contract own, make dem do am so tay if you no finish your project you no dey get money. Another thing be say make our Media dey involve, any project wey government award and the company wey win am make dem publish am. If the people wey win the contract no finish am, make dem arrest the criminals wey dey involve. He go good if dem make am law say if person thief government money, na treason be that and the thing go cause the person life. I know say I no get all the answers, but if we want make our country better, we must change our ways and lifestyles. Na here I go stop my people, make una dey do jeje o.

August.17.2001

Councillors for Akwa Ibom Want Eat Our State Dry

My people na me again o, how una dey, I hope una dey kampe. Plenty of these our so call Politicians no dey ceast to amaze me my people (this na the new oyinbo wey I learn from one University boy wey dey for our area). I don hear another one o, and I know say plenty of una don hear am too. But for una wey no get Radio for house or no get money take buy paper, this one na for una. No be Monday I hear say some Barawos Councillors for Akwa Ibom dey blackmail the Governor. Dem talk am say if out Governor no increase their salary, make the man kiss Election 2003 bye-bye. My people this na the people wey dey run the affairs of our Local governmet o. Se una agree now say no be only Men/Women of the Underworld be Thief, plenty of our Leaders dem be Ogbologbo for crime. Na dem and the Robbers dey share our National Cake.

Make I ask una this, una think say if una carry plenty money go this people office and dem come see am, se una think una go leave that place alive? I no think so my people. I wonder wetin dem do to the money wey Federal Goverment give their Local Goverment? How people wey we call our caretaker go dey sakara our Governor say the man no go get their votes this coming election? The question wey I want ask dem be say who tell dem say dem too go dey there next time around self? Wetin make dey think say people go vote for dem again with all these demands and pressure wey dem dey put for our state? But I thank God say the Governor talk say he no dey listen to dem. My people this na my type of Governor o. I no dey listen to una again, I know say plenty of una think the Governor too na Thief, but this time around I support am 100%. At least he no give-in to those yeye Councillors wey be disgrace to our state. Se na only these people dey for this world? Plenty of dem na to eat the state and country dry na him make dem join politics. Na God go punish all of dem wey dey thief our money. Make una see me se trouble o, una believe say plenty of these yeye people no pay their staff salary up till now and dem want collect raise from our Governor. Una see my people, se una see our politicians in action? If to say these Councillors no dey selfish, how dem go dey ask for Salary Increase when plenty family wey dey work for dem no get pay last month and the months before that. We don talk am before, I no know about tomorrow o, but these people wey dey represent us now only sabi their own. Dem no care if me and you no eat for a month, as long as their own pocket dey full for money.

My fellow Obodians, na here I go stop, I hope say all my people for Akwa Ibom go remember these Councillors dem next election. Make una count on me say all these people wey dey chop our money, na all of dem names I go list during next Election. Make una dey do jeje o.

August.15.2001

Haba Judge, Wey Your Common Sense?

My people how una dey today, I hope una dey watch everything wey dey happen around una? Another one don sele o, and na for Ekiti State I dey. Se una remember early this year or so, wey we hear say our Government dey give people wey dey go Mecca money? Plenty of una write me say una no support that kind thing especially when we get plenty religions for our Obodo. Today own dey different small, I go even say this one dey wohwoh pass the other one own.

No be last month or so wey hear say one Governor dey take our money send some Politicians (Legislators) go Jerusalem. He no tay wey the thing happen na him our Brother Lawyer Falana take the Governors and his Barawo Legislators go Court. When I hear the thing, if una see as I jump una go think say I don win Pool. But he no tay wey the thing go court na him we hear say the yeye Judge talk say our Human Rights Lawyer no get case. The Ode/Mumu (Dumb) Judge talk say since the Human Rights People no fit show say the thing go affect dem, Him dey throw away am.

How the yeye Judge think all those people wey don become Robbers take become am? If to say the few money wey dem allocate our State our Leaders dem take am create work, some of these people go become a better citizen. From there dem no go dey attack people like our Human Right Lawyer Falana and the rest of us. So which kind case the Judge say we no get?

My people se una hear? Where dem dey get this kind Judge and which School give am Law Degree self? How the man take become Judge don pass me o. I no sabi this one, how person wey get sense go make that kind judgement. Ordinary people, I dey talk about commoner like me wey no sabi book, know say this one na common sense. How the man go talk say the money wey those Fraudsters wey call themselves Politicians/Legislators want take go Jerusalem no go affect us? Se the Judge dey go garage where plenty small Conductors dey as their Papa no fit find money send dem school. Abi na Univesity Students wey no fit find Job since dem comot school na him make we talk? Heh my people, where this yeye Judge dey when dem talk say 95% of our Graduates no get work? Which kind constitution go talk say he dey ok make we use Public money dey send people go Pilgrimage? If the thing dey, make dem burn am. Which kind yeye thing be this my fellow obodians? The thing no gree me think self. We dey talk say work no dey, plenty family no fit find food eat and the few money wey dey, our Leaders don spread am around among themselves and their cronies dey take am dey feed their ugly faces. Se dem want tell me say these Legislators no fit afford money go Jerusalem? The thing wey I no sabi be say, wetin our people go benefit from this jounrney self? Today na Jerusalem, Tommorow na Mecca, which time una go send some of us wey dey practice Traditional Religion go Brazil? All this thing na waste of money I see am; and na this kind thing dey make people think say our Leaders dem no care about our Obodo. Na only their own dem sabi. Small time dem go talk say Federal Government no release their money, I dey pray say one person wey close to Uncle Sege go see this my comment and go tell am. If to say na me be am, I no go give that Governor and his cronies salary for one year. As be like say dem get too much money for pocket. Dem lucky say I no dey work for that State, If to say na Ekiti State I dey work and I come be civil servant, if dem no pay me salary na the Governor and this Legislators na him I go take go court. And go beg the people make dem take my case go that Fool wey call himself Judge Babalola court. I want hear the kind excuse wey the Wobia go talk say I no get case. I no think say the Judge get common sense for upstairs. The money wey he go chop no let am see beyond his nose.

I hope say our Leaders dem go comot this kind Judge wey no dey apply common sense to law. My people make una no surprise if the Judge hand no dey inside our Politicians Pocket. Small time time una go hear say dem make the old fool Chief Judge. I hope say my people go remember who be their friends for 2003. The so call Legislators and Governors na 419 in disguise.

Na here I go stop my people, make una no allow these kind people hijack our freedom and Democray o.

August.13.2001

Poverty Dey Breed Plenty Babies

How dey go dey go my fellow Obodians, I hope una enjoy the weekend? As for me o, I no too enjoy am as my pocket get hole. Anyway sa, he go better one day.

Na wa for us for Obodo Nigeria o. We dey complain say we dey surfer but that one no disturb our Pikin Factory. No be this weekend my source for one local Newspaper talk say the new Population Data Sheet when dem just release for Obodo America talk say our population for Nigeria don reach 127 Million. Dem talk say na we be the 10th Populous Country for the world. Haba, as plenty people dey complain say Men of Underworld no let dem rest for Night, plenty of dem na so so Poi Poi dem dey take relieve the pressure. Wetin be this? Imam/Pastor you want go sell dem? Dem talk say plenty people for Third World Countries na so so sex dem dey do for Night. As rich Nations dey get better na so we for developing countries dey produce Pikin yanfu yanfu.

Na him want make me ask our expert for Nigeria this quetion because I no understand the thing at all at all. How people wey fit afford plenty pikin dey get few why we wey poor pass church rat and no fit afford am go dey born pikin like say we get Children shop for Jankara? This thing make me remember one uncle wey I get for London. Twelve years ago wey the man come home I come go visit am. When I reach him house I see say the man and his wife na two pikin dem get. As una know say me I get big mouth, nothing wey I see wey me no go talk. Na him I come ask am say why him no bring all his pikin come home? The man talk say se bi na dem dey outside dey play as I no sabi before say na two the man get. I come follow him answer with another question say as he get money so why be say na only two he born? The man come laugh, he ask me say where I want make he tey get the money? He come talk say besides, him no get that kind time wey him go dey pursue him wife when people dey look how dem go take survive. The man come tell me say him dey shock say I no get pikin because plenty people for Nigeria na to make babies na him be their past time. He come talk say se I no know say na person wey no get work and money na him dem born pikin pass. When the man talk am, I tell myself say he be like say this oyinbo country don dey turn this man head o. How person wey no get money go born plenty pikin, how he go take feed dem? I come tell the man say I no sabi that one o. He come talk say make I listen. He say person wey dey work and dey dey busy every time no go get time for sex because by the time wey he go reach him house he don tire. And if him wife too come get better work or business all those wahala go don make am tire by the time wey reach house for night. Plenty of these people, the husband and his wife no too dey see each other. But for person wey no get job and he come dey poor, him and his wife go dey see each other plenty time. Every time wey hungry catch am like this and he come see Iya Bonboy for house, wetin I think say go happen next? The man talk say na person wey no dey busy go get time for sex. Na the thing wey make poor people dey get plenty pikin be that.

My people that time I hear the man but I still no sabi the thing wey he talk untill I come reach house come look around my street wey be say I know say plenty of us wey dey live for the area money and us no dey meet. But na so so Naming Ceremony and Christening you go dey hear every day. Na that time the thing come make sense to me. If you reach our area, he go be like say na Baby factory you dey as you go dey hear yan yan yan for night.

My people na so una hear am o, wetin we go come do? We dey complain say food no dey plenty, the way wey our country dey go, make una no dey surprise if our population reach 500 Million by 2040 and 85 of dem na gari be their staple food. I pray say this poverty wey don take control of our Obodo go stop and our Leaders dem go create plenty work for us so we no go fit get time for Poi every time wey we see our wife dem. Na here I go stop my people, I hope say all of us go look at our pocket before we ask Hajia Silifat/Mama Ronke/Mama Ngozi make she come inside come rub our back. As the country dey so,  we no fit support one more Pikin, please make una think before una do am if we no become like our Brethens dem for Somalia

August.10.2001

South West Governors Want Hijack Election

How una dey my fellow Obodians? Make una no worry, one day sa our Country go better.

Another wuruwuru want sele o my people, and na our South West Governors one start am. No be last week I hear say the Wayo Governors dem dey talk say dem go support Uncle Sege if the man agree say his party no go contest for South West area. Before before, una believe say plenty of these Governors dem dey among the ones wey I think dey try for our people. As I know say he no dey easy to rule for this our Obodo. Na so everybody go dey talk say wey my own?

As I dey talk before, this new thing wey I hear I hope say no be so dem talk am. Make we look at the thing well well self. Which kind deal dem want make for our people? I understand say the man na our Yoruba brother and he dey do him best. But one thing wey I no sabi be say, se make we vote for person because he come from our area, abi because the man na him be best candidate? My people una sabi say plenty of these governors dem study for Obodo Oyinbo, dem want tell me say this kind thing dem fit try am for those places? Na one of the things wey I no like about our people wey read for Oyinbo country be that. Make una listen my fellow Obodians well, anytime wey something no favour dem, dem go talk say our people no sabi anything. Na so you go hear dem dey talk say for Britain na so dem dey do this, and for America na so dem dey do that. But when dem sabi proper say this one go benefit dem, that their yeye rule go just dissapear like that. Na mee you go hear. Una no go hear a word from dem. Me I call those kind people "OPPORTUNISTS" as Oyinbo people dey say. If una call una self opponents why una go dey make wayo deal wey go put our democracy for shame. Na the thing wey I go call the biggest Wayo be that for this new Millennium. If una think say una dey do better work, why una dey worry una self about that kind thing. Unless the money wey una take they build houses for America na from our Treasury una thief am. He be like say all those sakara wey these Governors dey talk say South West na for AD na empty boast, doubt don dey crawl for dat their corny corny head.

My people, this no be joking matter o, this kind thing wey these people want start no dey good for our country at all at all. Una see my people, Non Yoruba wey talk say we Yorubas too dey play tribalism no lie for here o. If to say na Notherners talk say dem want make that kind deal with Hausa President, na so you go hear our Pro Democracy group go dey yell foul and talk say Notherners want dominate Nigeria. Where dem dey now? Una want tell me say dem no dey for this our Obodo? If to say na Overseas dem dey, I sabi say dem dey read news for Internet. This kind silence make me wonder if these our Pro Democracy Groups no be Ethnic Organizations self.

My people as I go stop here, I hope our President go reject that kind wayo for the sake of our young Democracy. If these people agree for this kind wayo, I hope say our Anti-Graft Commission go go arrest dem for bribe because na the thing wey dem dey call Government Sanction Corruption be that. Make una dey do jeje o as una reject all these wayo deals wey our Leaders want put on us.

August.08.2001

Whch Kind Crazy Person Dey Make Those Yeye Virus Self?

How una dey my people, I hope una dey manage? Una no talk say una no hear from me this pass monday. Na this yeye computer Virus o. Na jeje I sit down for office wey one boy for our office talk say I get message for my computer. As I open the thing I come see say na of my friends for Bank na him send am. As I open the thing I read am wey the bobo dey talk say make I advise for something. Since una no say for our Office na me be Oga Adviser for everybody. Whether na person wey her husband no dey sleep for house o or na man wey just see omoge wey he like, na me dem go come talk to about the thing. With all this adviser self I no sabi why me no fit find woman for Lagos. I guess say the Omoges don see for my face say I no get kobo for pocket. If dem marry me, na hunger go kill dem. As I dey talk before my people, na him I come see something wey look like paper clip for the message I come ask one of the secretary for our office wetin the man want make I do with the clip. Which kind thing be this now? Na him the girl come talk say na attachment dem dey call am. He say na message dey inside the paper clip. Which kind Invention wey Oyinbo never try self? This one don pass me o, how the message take enter paper clip I no sabi o. Sebi dem talk say nothing wey fit enter needle mouth, how this people come do am now? Anyway sa, I come no fit open the thing. Na him I come send message to my friend for bank say the message wey he send I no fit open am. Small time the man come write me say no be him write am. To caught my tory short, before I know, everytime wey I want open document my computer go tell me say he need SirC32.exe before he go fit open am. As una sabi say I no finish Standard Six for school, how go come manage with this box wey dey call computer? Na him I come go call one of those computer boys for office make dem come see me see trouble o. Na him the boy come talk say na Virus. My people if una see how I be when the bobo talk say na virus na him my computer get, una go laugh me. I come ask the bobo say how the thing go get am when no be say I dey sick myself? Besides, even If I dey sick, how the computer go get am when dem talk say no be person dey inside am? Na him the boy come tell me tory about the thing.

My people some people dey craze for this world o. I dey talk about mad wey don pass Jankara market for Lagos. How people go dey manufacture virus for computer when plenty Doctor dey look for cure for disease? The reason why our Doctors dem no fit go talk to this people I no sabi. If this people fit dey create this kind thing, before you know dem go create computer wey go dey take our omoges. Na wa o, this Oyinbo people don pass me o. Which kind brain wey get for Africa self? All those juju wey dey take harm people, why we no fit turn am and do something positive for our race. Which kind head we get for Africa wey be say na to destroy our own kind na him we sabi pass. Na the thing wey dey kill our society be that, he for better if plenty African Leaders go put money where our pikin dem go fit develop their brain, instead na to spend the money on their concubines and buy motor na him dem sabi. I don talk am before, all these our so call Leaders dem be cause on us. Na to chop the Continent dry na him be their mottor.