Pidgin English Dictionary for our Readers
 
|
Pa
Mugo is a periodical editorial in Pidgin English (broken english).
On this page, Pa Mugo's focus will be on events in our country
Nigeria and among her people both within and outside the country.
We promise our visitors that nothing or no one will be spared
in situations involving Nigerians. Pa Mugo- the Senator of the
Masses, will talk about everything under the Nigeria's Universe.
The opininon does not necessarily
reflect the views of the staff and management of KEK Technology
Inc. and its affiliates. Click here
to send message to
Pa
Mugo. Home News
January.21.2003
Pa
Alex Ekwueme na Cry Baby
My
people he don shele o, the thing wey power by force go cause
for our Obodo, I no sabi where he go end o. Se una don hear
say our Papa and brother Ekwueme (former vice president) don
take Uncle Sege and him party go court say dem do dabaru. The
man talk say President Obasanjo no resign from their executive
committee before he contest for their party election. He even
talk say the man no follow guidelines wey dey their party constitution.
Him talk say since the man no follow the thing, make court cancel
the election wey dem do three weeks ago and come do another
one. He even talk say as the man no resign as dem talk for party
guidelines, make dem comot Obasanjo and come put him make he
run for their party.
My
people se una dey hear our former Vice President. Where him
dey before their primary, no be dis our Obodo. You mean say
him no fit talk dis thing before dis their yeye election three
weeks ago? D man surprise me self, him be person wey I respect
well well not because me and am come from dis same village but
because na man wey get integrity and dey respect himself. But
as he dey behave so, dis man don dey yeye himself. As una sabi,
Uncle Sege no be my favourite but the thing be say I no dey
like person wey no get backbone, and no sabi when he don lose.
He want force himself on us abi na wetin, you mean the man no
sabi when to call am quit? The man don lose make he move on,
all dis afterthoughts ideas don pass me o. Sebi no be yesterday
dem born the man, he sabi all those games wey dem dey play for
politics. Dis one own na crocodile tears wey no go solve anything.
The man come dey behave like small pikin wey no want gree say
he don lose for fight. He for say the man talk all dis talk
before election people for support am but as the thing don pass
and his party don elect Uncle Sege, he go good make him just
go sit down jeje. Why he no complain during election? You mean
he want tell me say he go allow dem make dem do another election
if to say na him win and Uncle Sege come lose, and Obasanjo
supporters come talk say since Uncle Segen no resign, make dem
do election again? I beg my brother all dis because of power
to chop our money. Sebi him and Shagari play dis same game on
our Elderstatemen Pa Zik and Awo 20 years ago. Na the thing
wey Oyinbo dey call Nemesis be dis, God don play am as he play
those men of great honours.
All dis him hilahilo
na yanyampu and he dey too late. I hope say no be say the man
dey take style want cause problem for President Obasanjo so
our fellow Ibo candidates wey dey other party go fit win. Dat
one na abomination and he no good for person of him caliber.
Sebi
the man na doctor and him get sense well well, how come he no
declare him candidacy long time ago wey he com come out three
weeks before their party election. Nawa Uncle Alex, you no play
am smart out, you want contest against current President and
you no declare your intention wey wey before election, how you
want tey win my brother? Dis thing na common sense and our brother
Dr Alex no get case for dis one o. Person wey don declare two
years ago no win, and you come expect you wey declare three
weeks before election go come win against the President? He
be like say our Uncle Alex think say na village election dem
want do for here.
My advice to am be
say make he just go sitdown jeje dey enjoy him grandpikin dem.
People wey dey advice am just want make am yeye himself.
Na here I go stop
my people, make una take am easy o.....................
January.13.2003
Southern
Politicians Na Babanla Mumu
My people Happy New
Year, I hope say una rest una body and soul well well o. I for
don talk to una but I talk say make I allow una rest small,
as say plenty of una travel una village go enjoy. Another thing
be say una village no get light wey una for take dey read my
tory for Internet.
Any way sa, I pray
make dis year better pass last year own for all of us (Amen
/ Aminat Yarabi). My people make I ask una dis question especially
una dem wey come from southern part of our great obod. How come
plenty of una so call Politicians no too dey use dat their korokoro
head self? Na everybody sabi say for Nigeria, na people wey
come from anything below River Niger dey read book pass. Na
there you go see wey a whole family go be professor for University.
Anything wey involve book own na Southerners people go first
look before dem go think about us wey be Northerners. But the
question be say with all those advantages, my people for south
no sabi use the thing to their advantage. All dis tribal politics
and greed no make our so call leaders use their common sense
at all.
I
know say as una dey read dis thing plenty of una don dey cause
my mama and people wey dey for my village. But my people make
una hear me out first o, before una start dey call Pa ‘Mugo
names. Sebi all of una dey read all dis politics wey dey happen
for our Obodo Nigeria Papers. Last time wey I hear, dem talk
say since my people for North don rule dis our Obodo for long,
dem talk say dem go allow make person wey be Southerner rule
for sometime before the thing go shift base again. But as he
dey so, make una no surprise say na my kinsman from North go
rule us again. The reason be say plenty of our southern Leaders
dey too selfish for their own good, dem too dey play dis do
or die stuff wey be say if dem no fit win dem no go allow their
fellow southern win the thing. As for some, since dem don taste
power, dem no want give chance to other people from their region.
See Uncle Sege wey be say him don rule twice already o, I no
sabi why he no fit gree retire for the thing so other southerners
wey come from South East or South South go fit run for the thing.
But as the man don taste the thing, na how he go repeat time
na him be his goal. Dat I see say na greed and dis talk say
he be God fearing person and no like material things na rubbish.
Wetin to be in Power come be, no be material? I beg make una
go sitdown.
And as for other
southerners wey dey All Nigeria Peoples Party (ANPP), make dem
go bury their heads for sand including dat useless Okadigbo
wey no get any sense of decency for body. Because the man want
rule at all cost na him make am dey sell him soul. The thing
wey I no sabi be say why the man no fit say no to number two
position as everybody don talk say make dem give southerner
a chance. If to say him too refuse just like him fellow southerners,
Buhari no go fit be number one. He no possible make Northerners
be number one and two. Dat one no go work for our country, but
as he be say our so call Southern Leaders na everybody for him
own, dem don outplay dem selves again as usual. And na dat dey
make my people for North dey win the thing with no problem.
Se be Senator Okadigbo be Doctor for Politics, if to say I be
the man I go tell the University wey I go school make dem give
me my money back. Because the man no sabi opportunity if he
see am. If to say he refuse the thing like his fellow Southerners,
him party no get choice, dem for make one of dem as the presidential
candidate by force. If to say he do dat one, an Ibo person go
get clear path to Aso rock for the first time since our Late
papa Zik. As he be say plenty Northerner Power brokers no too
take to Obasanjo, the next best thing for be ANPP southern presidential
candidate wey for be person from South East or South South.
Instead na second fiddle na him he want play. Make he forget
say he go ever become President, dis don show say the man with
all him education, he don fail for pratical na only theory he
sabi. The thing wey him no sabi be say, wetin make am dey sure
say even if his party win and him come become VP, come Year
2007, dis Buhari too no go play the same game wey Uncle Sege
too dey play now? Another thing be say, even him fellow South
Easterns fit no gree am easy passage just like the Yorubas fit
no gree make their kinsmen no dey for position of power for
two elections.
So my people make
una no blame my kinsmen for North o, dem just tell our Southern
Politicians say dat book wey dem sabi no be anything when it
come to Nigeria Politics o. Thanks to our southern Politicians
like President Obasanjo, Senator Okadigbo and the rest of dem,
the road don open again for my fellow Northerner.
My people na here
I go stop, make una dey do jeje o.
January.01.2003
Haba
Yoruba Leaders, where una sense of fairness?
My
people how dey go dey go? I pray say dis New Year bring us plenty
money and booze. Another injustice don happen again for our
Obodo wey I no sabi why. No be two weeks ago I hear say our
Leaders for Osun Assembly say dem go comot Deputy Governor Omisore.
I hear dem talk say the man action dey affect his position and
political Party. Dat one na their palavar but the only thing
wey me dey against the kind talk wey follow from some of our
so call Yoruba Leaders dem. I no like the way some of our Yoruba
leaders dey treat the man and Deputy Governor for Lagos State.
Even if dem no gree with the two deputy governors he no mean
say we go dey treat dem like lepers. Sebi dem be Yoruba people
like us, how come because dem no gree with their Governors dem
na him be say we must bury dem alive. Which kind government
we dey run self for Nigeria?. As he be so, plenty of dis so
call Leaders dem no get any respect for my face. Sebi dem talk
am say as person grow na so him sense too go grow with am. But
the kind thing wey dis our so call Yoruba leaders dem dey do
I no sabi am atall. Dem too dey take side for matter (wey plenty
time he no concern dem) wey I go think say as dem dey old so
dem go apply dat their wisdom small tay settle the matter, instead
na kerosene dem dey pour for the thing.
Immediately
wey we hear say Osun State Assembly don impeach Deputy Governor
Omisore na him we hear say some yeye Leaders dey talk say make
Police arrest the man. Me I no sabi if the man dey among people
wey kill our Leader Ige but the thing be say which person appoint
dem as Jurists and executioners? Why dis so call Yoruba leaders
no fit let police do dem work instead wey we go talk like say
we dey there when the crime occur. The way things dey go for
South West, make una no surprise if another “Wet e” (war) happen
again o. Na the same thing dey happen for Lagos State between
Governor Tinubu and his deputy. I hope say no be chop money
wey Governor Tinubu dey give our so call Yoruba Leaders dey
make dem no too dey use their sense of justice for dis matter?
Sey dem want tell me say Asiwaju of Lagos na saint him be for
the palavar? Sebi na Yoruba belief say person wey hear one side
for quarrel before he decide na yeye leader/ Elder he be and
must be condemn. Why dem no fit use dat wisdom settle the matters
instead na how dem go tay destroy the house na him dem go dey
plan. Where all the other fair-minded Yoruba leaders dey self?
My people the kind path wey plenty of our so call Nigerian Leaders
dey follow fit dabaru the whole country o. Dis problem no be
Yoruba problem o, I see the same trend for all our Obodo corner
corner o. Na the same thing dey happen for South East when Senators
Anyim and Nzeribe dey fight, wey some yeye Leaders dey talk
say make dem ban Nzeribe for Senate. The thing too dey happen
for North o. Na pray I go pray for New Year say make God / Allah/
Ozonubua / Chineke / Olorun help us raise leaders wey go do
right by us.
Na here I go stop
my people make una dey do jeje o. Happy New Year……
Dec.30.2002
Wetin
Commander-in-Chief mean self?
My
people, we don plan before for our office say I no go release
any comment till next year, but all dis things wey I dey hear
for our Obodo no gree me keep quite. For example, dis talk from
some states say dem no want our President make him come campaign
for their states I no want hear am atall atall. My people as
una sabi no be say I like Uncle Sege, but the thing be say since
say for our Obodo now na him be our President, he go good make
we show am dat respect. All dis yeye leaders and governors wey
dey talk dis yanyanpu talk, how many of dem fit talk so for
Military own. No be last month or so we hear say some of our
Leaders for South East dey talk say make the man no come their
states. Now I dey hear am again say some states for North no
want the man come their states too. Which kind democracy we
dey run wey be say na only people and parties wey we support
we go allow come visit our states? Just as other people get
right na so for our current Commander in chief- Obasanjo. If
una no support the man na una problem be dat, no mean say commoner
like us wey dey una states no want support the man. Even self
if to say na only one person like am, the man still get right
as a candidate, and he fit go any state wey he likes just like
any other candidates. All dis una yeye talk fit divide Nigeria.
Dis kind thing wey una want start fit dabaru Nigeria o.
Wetin
una go do if Obasanjo people too come start the same thing say
any person wey no be Yoruba dem no go allow am for South West?
And the thing no stop there, dem come talk again say any goods
wey dey go another part of Nigeria no dey pass their area wetin
una go come do? Small time Midwest start their own, South East
follow, North Central begin their own, North East, North West,
before una sabi the thing don cover all Nigeria. I believe say
for election own, we must give everybody equal access and chance.
As for una wey no like Uncle Sege, dat one na una personal problem.
Plenty of una na the money wey the man no let una chop na him
dey make una dey attack am now. Last time wey him people for
South West talk say dem no want the man una no hear, as the
man no come give una everything as una dey enjoy before una
come dey talk say the man must go. Una dey look for person wey
go support una interest like say other parts of Nigeria na stepsons
wey no get rights. All dis yeye interest palava stuff, I no
sabi why our National Assembly no put am for Constitution wey
every tribe and part of Nigeria interest go dey protected instead
of all dis Tribal politics wey we dey practice. As my brother
for America dem talk “ make una deal with it”. The man na commander
in chief, no means say na for only poor people or him kinsmen,
na for all Nigerians. If una no like am, April go soon come
wey una go let una voice count and vote against people wey una
no support. But my people before then, na the man be our President
and we must respect am even if we no agree with him policies
and progrmmes.
As
for Yoruba leaders, na shame on una. He come be like say the
man no get any support at all even from his own people. I know
say una no support am during last election, but no mean say
una must abandon am when we know say the others no they fair
to am. Dis no be because na Yoruba man but because na our President.
Ever
since I sabi una, una be one tribe wey dey fight for justice.
And una always dey dey fair to people. The Yoruba people wey
I sabi before no dey vote for person because he be one of dem
na because he get good programmes for all Nigerians. If una
no like a man programme even if the person na una pikin una
no go support am. Why una come dey quite? when una know say
all dis yeye people wey dey talk bad about Obasanjo na chop
chop dem dem dey look for no be say dem no like the man because
him programme no good for common men but na because dem no too
find money chop as before na him dey make dey complain about
his regime.
My
peopole na hear I go stop o, I hope say all better stakeholders
wey we get for our Obodo go think hard about dis things o. If
people no want Obasanjo again na their right be dat, but the
man must get access to all voters just like Ekwueme, Rimi, Nwachukwu,
Buhari, Gemade and all other contestants. Make una dey do jeje
o.
Nov.13.2002 Elections
2003: Make una Leave Am Alone
Wetin dey happen
my fellow Obodians, se una dey manage small small? Make una
no worry, small small he go better. Any way sa, we pray say
as dis year dey end, make we dey among people wey go see year
2003 and beyond o, Ami Yarabi, Amina.
I know say plenty of una say Amen for my prayer but as things dey go so for our Obodo
Nigeria, he go good if we add to dat prayer o because na dat year we go do election. And
for our country na real palava. I hear say people wey get plenty money no be the wannabies
o, I dey talk money wey Ghana must go bag no fit fit, don dey buy tickets for their family
make dem run go obodo Oyinbo as dem sabi say wahala fit happen. My people I no blame dem
o, if to say I get money, no be me and una go spend Christmas and New Year for dis our
country o. I for don dey for Switzerland dey miliki but as I no fit buy spoke for my keke
own, na him be say Pa Mugo go dey here kampe.
So my people na dis come bring me to all dis talk say make our President no run for
re-election. Some people say make our Uncle Sege do the same thing wey our baba for
Africa, Pa Mandela do for South Africa. But the thing wey I no sabi be say Nigeria no be
South Africa and Uncle Sege no be Pa Mandela. If the man talk say he want run for another
election make he run. Na him get himself, sebi if he no win, Ota dey there wey he go pack
him load go. No be say I dey support our President o, but the thing be say as dem dey talk
for America, "the man get right" and even self, sebi he dey for our Constitution
say President fit run for re-election. All dis yeye talk say make he allow South East
person for President na yanyampu. No be three years ago the man reach the thing, wetin
happen to dis talk say make each region do am for two terms before the thing go another
region. No be for almost 30 years our brothers for North rule us, the man no reach four
years and we don dey talk say make he comot. If to say no be magomago our Leaders dem dey
do why dem no allow our people vote am comot if dem no want am, abi wetin dem dey call
Democracy? if our people for Nigeria no want am the man go hear am for election. I think
all dis people wey dey complain dey afraid say if dem compete against am dem no go win.
All dis talk na because dem no get better thing wey dem fit sell us as their pass don dey
catch up with dem.
My own be say if the man dey bad as dem talk why dem no allow us make we take vote comot
am for him Post. If people think say the man no deserve another term dem no go vote for am
and if we think say na him better everybody na him be say the man go sleep for Aso Rock
for another 4 years.
As for our so call Leaders for South East wey dey talk say make the man allow person from
our region, I hope say dem sabi the adage for Yoruba land wey talk say "stick wey dem
take drive first wife comot for house dey for roof top and na dis same stick dem go take
do pattern for second wife back". Na beg I take beg my fellow Igbo make we remember
say if the man come resign because of our us, make we no complain if other people come
bring the same palava four years from now. Before we blink our eyes, four year go pass
fiamm, wetin we go come tell dem if other people talk say make we comot? I dey pray say
make dis our so call Leaders no let their own greed and ambitious spoil our turn when we
fit rule for two terms. If dem follow all dis yanyampu talk say our turn na now, na him be
say four years from 2003 the thing go return to my people for North.
Make I tell una true true, I no believe say our President deserve another term but the
thing be say if he want run make we let am run, he no mean say we go vote for am. All dis
yeye people wey dey for National Assembly I hope say people wey get better program go
drive dem comot for next election because dem be BIG DISGRACE.
Na here I go stop, make una dey do jeje o.
Nov.07.2002
Our President Na Wayo Man
Wetin make our President think say people for our
Obodo na mumu? I no sabi the man o, person wey think say the man no dey use agbari na him
be say dat person na real Kutelu. How una dey my people, I hope say una don dey ready for
Christmas and as for my Muslim brothers and Sisters dem, Happy Ramadan. I for join una but
the worms wey dey inside my belle no gree me o. If food no enter my belle as I dey so na
him be say time don dey reach wey my forefathers dem go get visitor for yonder.
Make I continue
with my tory ojare. No be last month our President Uncle Sege
talk for Plateau State say him dey sorry for the wahala wey
happen last year wey plenty innocent people die for our Zombie
boys hand. Plenty people dey ask me say why the man no talk
so last year when the thing happen. I no even think say the
man visit the place as he dey busy dey fly around the world
like bird wey no get diretion. But my people I hear say plenty
Leaders for Plateau State no buy him yeye apology because dem
see through him wayo mind. Sometime dis kind thing dey make
me wonder which advisers dey advise our president self. He be
like say the people and the person wey dem dey advice, na all
of dem dey face west like Cows for Apapa wey no get direction.
But I no fit too blame dem because our President sabi right
from wrong, Uncle Sege sabi the thing wey he dey do. As for
me o, I dey behind the thing wey those leaders talk for Jos.
Make we look at the thing self, how come our President just
dey visit the place, why he no visit dem last year? I know say
plenty of una sabi the thing wey our Uncle Sege want pull. As
the man don dey hear for Core North say dem no go vote for am,
na him make am change him plan for my Middle Belt Kinsmen. The
man think say if he tell my people for Middle Belt say he dey
sorry for the thing, the people go talk say our president beg
make we forgive am and he go fit use dat win their votes. But
my people, I think our President don fail for dis one o. I pray
say the people no let him yeye apology fool dem for eyes o because
the thing wey happen last year no better leader wey dey think
about him people go do dat kind thing. I trust my Tiv people
dem don shine their face well well.
My fellow obodians,
which people dey talk say our President no want become president
na beg dem beg am make he take am self, with all the things
wey dey happen he be like say our President go even sell him
pikin for dis post o. If una look the kind deal wey the man
dey make una go know say person wey go drive am comot go try
real hard my people. No be two months ago I hear say the man
ask General Banbagida wetin he want make he do for am, if he
want his support. I hear say the man tell am make he comot some
minister dem. As I no dey there, I no sabi if the people wey
talk am dey nack tory or na true. If the man comot his friends
na him be say his political career don finito be dat. As my
brother for America dey talk say "IF YOU NO STAND FOR SOMETHING,
YOU GO FALL FOR ANYTHING".
Na here I go stop my people, I pray say our
country go be like America wey people wey lose Election go take am kampe no be like our
people here wey be say Na hire killer and Juju dem go take settle the thing. Na wa for us
o.........
Nov.05.2002
M. Abacha
Money Trail Saga: See as our Asewo Leaders dey Sell their Souls
How dey go dey go my people, I
hope say una dey kampe? I know say plenty of una dey wonder say wetin happen to me, my
people I thank una wey send me messages o, may dis our Almighty God, Allah, Chinenke and
Olorun bless una proper.
But he no good if I no tell una the thing wey cause my missing
in action (MIA). Se una sabi say soup wey sweet na money kill
am, na our Oga send us home make we go rest small as him money
run out. Na only God say the man get wife wey get small money,
if not, our company for don packup. I hope no be dis kind talk
go make our Oga comot me patapata as I don put him business
for Internet. But make we talk true, how come people no dey
think well well before dem start business, when no be by force.
I dey think before say our Oga na won Agbari o until dis palavar
sele, na him be say part of our Oga brain dey for him yansh
while the other dey sleep for Jankara market. Because I no sabi
why he no put him thinking cap for dat him Hurbert Macauley
head before he start dis yeye thing wey he call business. Anyway
sa, no be him be my palavar today.
My people which kind Obodo be our own wey be say na Barawos
dey call the short? If dem say make Uncle Sege jump de man go
say how high. Nawa o, how person go thief our country dry and
people go dey flock him house like say Ole na better name. Sebi
una see how Mohammed Abacha treat our government like say our
country na him papa kingdom. Dem talk say the man and his Barawos
Family make agreement with our yeye government say if dem free
am for jail, him go give us back our money wey him and his scum
for dis earth friend (Kashoki) thief for our Treasury. Una believe
say soon the man comot for jail, him talk say he no make deal
with our government. Before I pound on am, make I talk about
our yeye President, if una dey talk about person wey don sell
him soul, na our President be number one. The man too dey talk
double talk, how you go talk one minute say you dey against
corruption and come turn around and release person wey commit
greatest crime person fit commit because you want win re-election
by force. Una mean say if our President no win re-election him
life go stop? The man release the bastard because he want our
Power that be Northern leaders votes. As if to say the rest
of my people for north na zombie wey no get mind of their own.
Since dat day, I don loose respect for am, the man no get principle
at all.
Na him bring me back to those yeye Politicians wey flock Abacha house because dem want
collect some ill-gotten money and get his support at the same time. The one wey pain me
pass na dis yeye Governor Kalu. I no sabi why my people for East no stone the man when he
come back from his shameful trip. How one family go thief money wey our Government for
take improve our lives, and some people we no get back bone go dey sing their praises like
say dem be God. No be dis year UN report talk say our country dey among countries wey poor
pass church rat. And no be say we no get resources, the problem be say the only people wey
our country dey punish if dem thief money na highway robbers and poor people like us. If
you dey big and you thief money, na deal our country go make with you and you no go smell
prison if you sabi your game well. Na dis bring me to the yeye Sharia law wey our
Governors for North talk say he go help clean our society. How many of dis yeye Governors
and Leaders talk say make Abacha dem face Sharia law, but dem fit use am punish poor
hungry person wey thief Goat for Zamfara. Na there you see am my people! dis country no
get leaders na wolfs dem na him plenty for our National Assembly and State Houses. I pray
say make spirit of our innocent pikin dem wey die because dem mama no fit find money buy
food haunt dem and their household till dem yamutu (Amin Yarabi) because our so call
leaders na murderers and dem be excuse for human being wey no fit live among us..
Na here I go stop for now, I dey beg una my fellow Obodian make una shine una face well
well o if una no want be victim of our wayo/pen robber Leaders wey dey for our mist.
June.19.2002
Haba National Assembly, Why Una Want Impeach Uncle
Sege?
How life now my
people, I hope say una dey manage? I sorry say he don tay wey una hear from me, na because
we no too find tory cause dis long silent be dat.
The thing wey I want talk to day plenty of
una don hear for radio and television. As for una wey no hear the thing, dem talk say our
National Assembly dem want comot our President because as dem talk since I no dey there.
Dem talk say since dem don dey pass Bill wey our President send dem, dem talk say the man
no too dey implement the thing wey dey inside. Na him be say the man no dey carry out
projects wey dey for the Bill when the thing comot National Assembly. Na because of dis
dem say make dem comot Uncle Sege as the man no sabi him work.
My people I know say I no too sabi our
Constitution for our Obodo, na all of una sabi say na Standard six I stop for school. But
for dis matter own, I go talk say our House of Representatives na dondy United plenty of
dem be. Even self people wey no sabi book like me know say our National Assembly no fit
impeach person because he no fit carry out all the projects wey dey inside bill wey dem
pass. Sebi I hear say our National Assembly job be say make dem pass bill wey our
Executive send dem, wetin concern dem if the man no implement everything wey dem for the
Bills? Sebi all of dem sabi say soup wey sweet na money kill am, se na all of us dey here
wey dem talk say our Country no too make money for Oil own dis year. Where dem want make
the man find the money since we hear say our National Assembly dem add money to the Bill
wey our President send dem. Make those yeye barawos no tell me say na because the man tell
the whole country for the magomago wey our House of Representatives want try as dem want
take style thief money from our Treasury. Se yeye allowance wey dem dey allocate dem no
do? See the yeye people wey want impeach person, who we for impeach for the place if no be
dem? How President go talk say na only 1 Naira he go need for the projects wey dey inside
the bill wey him send dem and our National Assembly dem go come turn around say na 3
Naira.
My fellow Obodians make una tell me, who be
barawos for dis matter if no be our yeye National Assembly? The thing wey pain me pass be
say with all those yeye lawyers wey dey wakaabout for our courts dem dey look for work,
una want tell me say dem no fit carry our National Assembly go court for dis kind
Ojukoroju fraud wey dem want carry against our beloved Nigeria? As lawyers plenty so for
our Obodo, na real shame say our so call Leaders go dey carry fraud day and night as for
say dis na lawless country wey our politicians dem go fit do as dem want.
Dis yeye man wey dem call our Attorney
General where he study law self? If the man no fit take dis kind thing go court which one
he go fit carry self? Se na our Uncle Sege appoint people wey be say no fit sabi their
left hand from their right? No wonder people for Obodo Oyinbo dey call our country
LAWLESS.
Na here I go stop make una dey do jeje o,
one day sa the country go better.
May.02.2002
Plenty Of Our Northern Leaders Na Cry Babies
How una dey my fellow Obodians, I hope una don dey prepare una backyard
for Malu and Rice wey plenty of our Politicians go start dey bring una as dem want make
una vote for dem? As I see am, if person bring me Bag of Rice and plenty Ogogoro wey I go
take wash am down, I go take the thing and wack am, he no mean say when I go Polling
Station na him I go vote for am. My advice to my fellow obodians be say make una take
their thing and chop am, se dem don see mumu wey be say na only food he sabi. We go show
dem say the time wey dem dey take food buy our vote don pass, dis time we go chop their
money and no go vote for dem. Na my own contribution be dat o, I hope una go think first
before una start dey vote for dis Barawos dem wey be say na only when Election dey na him
dem go sabi say we be person. Anyway, make I start my tory before Oga NEPA use him power.
My people wetin una think about our Leaders
dem for North wey be say since we give power to our Yoruba man, na soso complain we dey
hear from plenty of dem. Since 1999 wey Uncle Sege don retire plenty of my people wey dey
for Army and Ministry, na him our Leaders dem don dey cry "MARGINALIZATION" as
oyinbo people dey call am. As the thing popular so, even person like me wey na Standard
Six I stop for school, don dey use am for talk too. The thing wey I no sabi for the thing
be say which people wey our President go retire when plenty people wey be Permanent
Secretary when Uncle Sege first start for 1999 na my people- na us Northerners full am. Se
na Southerners wey occupy 20% for Permanent Secretary Post na him dem want make the man
retire? Why we no hear dis crocodile tears when Babangida and Abacha dey for power. Abi
because na our people full the place when those Looters dey for post, dis injustice cry no
dey for our minds? If we talk say dis country belong to us while we no oppose those
Military Leaders when dem put plenty of our people for the thing? I don tire for dis
"na we put the man for Power" cry self, se dem mean say because the man na we
vote for am make he come ignore other Nigerians wey dey because dem no vote for am? Abi we
don become the CHOOSEN ones as dem talk for Bible. Even self with all dis complain, why be
say when our people dey for power, South still get plenty Industry pass us? Plenty of our
people na Beggars dem be all over Nigeria, se dis our "so call Leaders" no dey
alive when all dis things dey happen? When our Past Leaders dey give dem billion Naira
Contracts, why na only their family and friends dey enjoy the thing? Wetin dem take am do
for all my fellow Obodians wey dem now dey call their people? As Southerners talk, the
only answer wey I guess for dis "Parasites" be say since dem no fit win contract
and all the money wey dem use dey chop for our National Reserve no dey again na dat time
dem remember say we be Northerners like dem. Se dem want tell us say no be dis our Obodo
we dey when their pikins go dey travel plenty Obodo Country like say Planes na their own
Danfo?
So as their season don end, dem come
remember the poor people wey before, their pikin go take BMW pour gutter water for him
clothes because he dey beg for road wey dem think say na their papa private backyard. Na
all of us be Northerners now, I guess say dem still believe say we be mumu wey no get
sense for head.
The thing wey I go talk be say all dis
their complain na only small pikin go dey cry like dat, dis pot belle Rogues na Cry
babies. I no sabi why dem no want accept say their time don pass. Dis Northerners talk no
go work again since we poor people don sabi their wayo. How many of dem go allow their
daughters dem marry those beggers pikin wey dey for road even if the bobo go University?
As we don sabi say Class dey for Nigeria, we go tell dem say we too get one small power
wey dem no go fit take from us unless we no learn from the thing wey dem do us in the
past. I go advice dem say make dem go cry for person wey go accept their yeye complain, no
be here. Because na only person wey go do right by all of us whether you be IGBO, YORUBA,
HAUSA, TIV, EFIK, FULANI, IJAW, IBIBIO, IGBIRA, ITSEKIRI, URHOBO, ISOKO, IKALE, ETC, he no
matter. We be all Nigerians, dis obodo na our own.
Na here I go stop make una take am easy o.
April.29.2002
Our President Na Hypocrite
My people I hope say una gbaladun dis weekend wey just pass? But as for
me, I no kuku enjoy am because of yeye thing wey dey happen for our country. Dis week I
get plenty tory for una. The first one na about our yeye President wey small time he go do
things wey una go think say na God send am to us and sometimes the man go behave like him
fellow Leaders wey be say na only their own dem sabi. The next tory again dis week na
behaviours of some of our so call Northern Leaders wey too dey act like say CRY BABY if
things no go their way. And the last one na dis ethnic politics wey plenty of our Leaders
dey practice. If dem no take time the way wey everything dey go make una no surprise if
the country wey wey dey NIGERIA no dey for Map again.
Anyway sa make I begin my tory about our
Uncle Sege. Plenty time wey una see the man, una go think say Messiah for our Obodo don
come when he dey talk about him plan for our country. If una compare am to plenty
President wey don pass dis our Obodo the man dey try small. At least the man sabi the talk
and dey do the work small small. But lately I no sabi if the man na dat the same man wey
for 1999 talk say him go make our country become obodo wey we go fit call our own and go
dey proud of. He talk say all the yeye injustice and corruption wey dey for our Obodo don
become history as he no go tolerate the thing for him regime. True true the man dey try
him best. But as my own be, since na we dey pay am salary, I no think say the man dey give
the thing all him power. But dat one na another tory for another day.
My problem with am na his announcement for
last week own. And he don tay wey the man dey show dat kind traits especially if the thing
go benefit am. The thing wey I no sabi be say na the same man dey talk two months ago say
make House of Representative dem tell am and the Nigerian public how much dem dey get for
for salary. Today me I go ask our President dis question, how much of him money dey for
dat yeye celebrations wey dem do for Abuja and how much come come from our National
Treasury dem? The man dey talk about corruption but wetin we go come call the one wey him
and his Arije (Waki and die) friends do for our National Capital? For una wey no too sabi
the thing, Rice and Drnks very Plenty, I hear say dem even close plenty public road for
the thing. And small time dis pot belle President go come dey talk say some of our leaders
no dey live by example. I guess say we don see the kind example him go show us for our
Obodo, na soso mouth and no action.If our President be person wey too get sense and dey
think well well, no be with dat kind fanfair he go announce him re-election for Obodo wey
almost 80% percent of our people dem dey live below poverty line as UN talk. Small time
him go talk about corruption, wetin Ben Bruce and the rest of dem wey head NTA dey do for
him committee wey dem be federal workers? Dat kind exposure wey dem give am who go come
pay for the thing. Se those parasites and Asewos go devote the same energy and exposure to
other politicians wey go contest for President, abi NTA na Uncle Sege personal Television?
Those roads wey dem block during his
Declarations, se him and his Personal Nigerian Police Team dem go do the same for other
Parties. I hope say if dem block the roads wey him dey pass during him opponent
Declarations, he no go tell our new IG make him go dabaru the thing? My people na so he be
for our Obodo o, small power wey people get like dis dem go take oppress others especially
their opponents. If na true true our President mean the thing wey him talk for 1999 say no
person dey above the law and and the same rules and justice for everybody for our Obodo,
he go good make he ask him re-election committee make dem put the money wey dem take style
comot from our National Treasury andorganize him Celebrations back to our National Account
since na for him own personal re-election the thing dey for no be official business.
Before I stop here, I want ask the man self, why he no fit do the announcement for Ota,
Ogun State self? No be there he come from?
I notice say our President too dey afraid
of our Northern Leaders dem. Him too dey dance to their tune. I guess dis him talk say he
no want power by force na HOGWASH as my brother for America dey talk.
I go dey talk to una my fellow Obodians,
make una dey do jeje o.
April.24.2002
Who Dey Fool U Now Oga Executives
How dey go dey my fellow
citizens, I hope say una dey kampe? Se una don hear say Auditors for our Accountant
General Office dem talk say plenty money our Ministry dem for put for Goverment Treasury
dem don dissapear and dem no fit find the thing wey our Civil Servants and Minsters do
with dem. Books no fit balance against goods wey dem say dem take money buy. If una hear
the amount, una no go fit close una mouth.
Na so I sit down jeje for my Abode dey
gbaladun with Palmwine wey my neigbhour Papa Ezekiel bring me from his farm. As I sit down
jeje dey enjoy the thing with am na him Mallam Shehu wey dey sell Suya around the corner
ask me if I don sit today paper? I come ask am wetin happen to am since I no say the bobo
no fit read or count except Kudi. Na him he come tell me say the Student wey dey live near
him house talk say dem read am for paper say Federal Auditors talk say plenty money wey
our government talk say dey for Banks/Safes, Abrakadabra don happen to dem; accounts come
no gree for plenty Ministry dem. The Mallam talk say as dem talk say we no go fit count
zeros wey dem talk say dey behind the numbers wey dem no fit find as the money plenty so.
My people se una dey hear, how money go just waka comot no gree me o. Which kind country
we dey self wey na Barawos we dey get for Top?
The thing wey I no sabi for the thing be
say, with all the talk wey our Uncle Sege dey talk say him no go tolerate make person dey
thief money or dey corrupt, una go think say the people go slow the thing down small but
as the auditors say so na him be say our President just dey talk to empty Seats for
church. Our obodo come be like the thing wey dem dey talk for my village, Pastor dey kampe
while congregation for him church dey suffer. Dis no be first time I go complain
about our Leaders dem especially our so call Ministers, until our President stop dey put
friends wey help am reach the position, dat corruption thing go just be talk. Na the same
problem we get for all the other places including our States and Local Council dem, if una
look all the people wey dem put for commisioner and important post own na their buddies
full am. No be say dem no sabi work but plenty of our leaders put dem so dem go fit theif
money for dem. He for good if our President fit start dey put people wey thief money for
jail or make dem face firing squard. Na only dis kind thing fit put fear or our people
mind if not dat book wey our Auditors dem dey look no go ever balance. Na here I go stop
my people, make una dey do jeje o.
April.16.2002
Oga IG Se We Still Be Part Of Dis Nigeria?
He don sele o
my people and I no fit contain myself my fellow Obodians. How una dey, se una dey kampe?
Me I no fit talk dis same o as our new IG don spoil the thing for rest of us.
Four weeks ago when I hear say our Uncle Sege don comot former IG for police, I dey among
people wey think say the thing fit better for our Obodo, since since the time wey dem born
me I never hear say Police dey strike before until dis year own. When I hear Police go put
their guns down and head to our streets, I say he be like the country Nigeria as we sabi
am don dey end be dat o. Make una no get me wrong, no be say dem dey do better work self
but the little sakara wey some of dem dey give Robbers and Area boys dem dey save some of
us life. How people wey dey in charge of security for our Obodo go talk say dem dey strike
na him be say Armed Robber dem wey be caretakers for our road go come become landlords for
the place be dat. So make I no take stick wey no straight kill frog, as dem comot the man
I talk say the thing fit good for Police dem as their morale don reach ground so.
But my people as I dey so today, I no think say the man time go dey good for all of us o.
Especially some of us wey be Igbos. Dis time around my fellow Obodians especiall Yorubas,
Hausa/Fulani, Ibibio, Ijaws, Efiks and the rest of una, our new Inspector General don draw
line for ground o. And if dem no want make dis country pafuka, I hope say una go tell the
man make he reverse course.
My felow Obodians, how many of una hear news say our new Police Boss (IG) announcement say
him dey promote some Olopas dem to AIG position? Se una know say na only my people for
South East no get person for the thing. We dey talk my people wey be third largest tribe
for dis our Obodo o. Haba, If to say na calabar people or Ijaw dem no get
person for the thing I for understand small. No be say I go support dat so since na all of
us deserve our people for the thing. But dis one o pass me well well make I no deceive
una. And I no want hear una wey come from other tribes say I dey complain too much because
if to say na una tribe no dey, na soso "A O NI GBA: and "KASIKO" we go dey
hear left and right. With de thing thing wey our Inspector General do so, I no think say I
go forgive am unless the man change the thing. Which excuse our Uncle Sege get now, how
our country go promote 16 people to AIG positions and my people wey be third for
population own no go even get one person for the thing? Na wa o, I guess my people wey
talk make we get our kind and make am run against Uncle Sege sabi the thing wey dem see
before all dis things. If una look the list na so so Northerners and Yoruba people full
am. Se una see say no person for other tribes complain about the yeye thing since their
people full am. All dis my own and our own wey we no fit stop go kill our country if we no
dey careful.
I don talk am before and I go talk am again, I no care which tribe he be, any injustice
wey I see, me I go talk o, I no fit turn blind eyes for dat kind thing. Se na Nigeria we
still dey? Where all dis Right Activists dey self? I wonder why all dis our Non Igbos
Right Activists no fit see anything wrong with dis Police promotions dem? Make una no tell
me say the people dey quite because plenty of their people plenty for the thing. Even self
some our Igbo Leaders too na disgrace, se dem want tell me say dem no see anything bad for
dis promotion thing? Person wey talk say plenty of dem na dogs wey just dey sleep around
no dey kolo.
My fellow Obodians na so I see am o, dis our country wey we call Nigeria no belong to all
of us o, dis kind thing don shake my loyalty for the place o. I pray and hope say our new
IG go correct the injustice wey dem pass on my tribe o kiakia before the thing cause
wahala. Na here I go stop my people, before una do anything, he go good if una think well
well before una do am o.
April.09.2002
Water Palavar
Life no dey easy o my
people, how una dey? I hope say una no vex say he don tay wey una hear from me. Na our
Almighty God/Allah I take beg una, make una no vex o. Any way sa, make I begin the thing
wey I talk say I go tell una last week. He don tay wey I talk say I go talk dis things wey
better country dey give citizens dem and for our Obodo, na only our government officials
dey enjoy am especially those yeye barawos wey call demselves our Leaders. Two weeks ago I
sit down for office na him dem tell me say I get message wey reader write. Na the thing
wey the bobo talk na him make me come remember dis topic again.
I know say plenty time I don talk for NEPA
palavar wey no dey improve for our Obodo own but today na WATER. I hear say he dey for UN
Constitutions say go provide fresh pipe borne water for him people. But for Nigeria, na
person wey dey for dat post before dem dem go dey blame. But dem don forget say no be
yesterday dem born plenty of us If you count all the people wey get better post for our
Goverment now, I go talk say na only few dey new. Our current leaders dem, plenty of dem
if dem no be Senator before dem go be Minister, and the ones wey be Governor now na former
Senators dem be before dis our Uncle Sege regime. Our brother Tinubu for Lagos dey among
dem.
So my people the thing wey I want talk
before I start dey run my motor mouth na dis Water palavar.
As nature be, you born pikin, small time
the pikin go start dey grow. Before you sabi, the pikin don become Man or as for woman
own, Omoge. Small time the pikin go marry and born him own pikin as God plan am. Just ad
he dey for person own na him the thing dey for Animal own. The say thing too dey sele for
Plant own. And dis thing too dey happen for everything wey dey for dis our Universe. Motor
wey una see for road too dey go old and I know say dat one no go surprise una since plenty
motor wey dey ply our Nigeria road na agbalagba kujekuje for motor age. But the only
country wey dis kind thing no dey happen na our beloved Nigeria. Since dem born me all dis
things wey country promise say dem go give their citizens dem, no dey exist for our Obodo
Nigeria. The world PROGRESS AND GROWTH na foreign Language for Our Leaders agenda. Why we
dey get Ministry for our Obodo I no sabi am my people. Make una look, why be say for our
Obodo, water wey dey important for person live no too dey for our country. If una go some
areas especiall for Lgaos, the last time wey dem get water, like light don reach two
years. Even papa, I no think say una go see new house for our Obodo wey no get Well or
borehole for him compound. Dis na must for our country as oyinbo people dey call am plan,
if you no get am na him be say na Water seller go chop your money finish. And if dat one
no happen, na him be say na bucket go put hole for your pikin head as dem go fetch water
tire. The thing wey pain me pass for the thing be say plenty of our Leaders no dey concern
for the thing. Since Head of states dey dey come dey go, I no fit mention one wey talk say
him go solve water problem for our Nigeria. Dat na last thing for their mind. And no be
say we no get water corporation but the small allocation wey our Goverment dey give dem na
him the official for the place dey take build mansions for their village. As we get water
problem na so everthing for our live don dabaru like Shomolu Taylor. Una sabi Oga NEPA and
his brother NITEL. The problem wey dem get when I be small pikin still dey around dey
destroy our Country. Say country go improve small small no dey for our own Vocabulary.
Everything for Nigeria na opposite, our country just dey die slow death, and our so call
custodians na Parasites wey just dey eat our country alive small small. Sebi una hear
Governor for Kogi State wey go buy mansion for America. The question wey dem for ask am be
say since he comot University and start dey work, where he get dat kind salary wey he go
fit afford dat kind house? But who go come ask am since plenty people wey dey for dat
position get their own mansions for Carribean beach.
So before I stop my people we for ask our
Leaders dem make dem tell us which basic thing wey dem say dey important for out life dem
go tackle? If person tell me when I dey small say when I grow up I go still dey go my
neigbhour house go fetch water, I go tell the person say no be for dis life. But una see,
sebi if your neigbhour get well na him go see water fetch, plenty people wey dey village
still dey go river go fetch water wey dem go drink. And Una dey wonder why plenty of our
people dey die young. Se una want talk say una no sabi say na the same river dem dey shit,
so my people how oyinbo life no go long pass us? Na here I go stop my people make una do
am well if na una turn.
March.27.2002
Which Kind Standard Uncle Sege Dey Talk?
My fellow Obodians
how una dey now? Se everything dey go kule? Me I still tanda dey look Cloud o.
I don hear anoder one o my people, our
President don talk another one for Abuja o. No be yesterday I sit down jeje dey enjoy Ice
Water wey my neighbour give me. As we dey gbaladun na him de man come turn him
Televisition on. Small time now, na him dem come dey talk for Television for meeting wey
our yeye African Leaders do for Abuja. Before dem go finish de tory na him dem come talk
say our Uncle Sege talk say make Oyinbo people (Westerners) no come put their Standard for
our head by force say we get our own standard for Africa. I hear him talk am say everytime
wey one African Leader no gree dem, Oyinbo Leaders go come dey sakara say dem no give him
country money. My people se una dey hear our President? No be say I no gree with am small
for dat talk but one problem wey I get for de thing be dis Standard wey de man say we get
for Africa.
I go come throw de say question to una.
Which standard our Uncle Sege dey talk o my people? If una sabi am make una tell me o as I
no sabi de kind standard Uncle Aremu dey talk Se de man dey talk de kind standard wey our
Leaders dem for Africa want turn their country to their papa properties? Sebi una see dat
Old goat wey call himself Mugabe for Zimbabwe. Una sabi say de man when Ian Smith still
dey for dat country dey among de people wey talk say Africans go do better job if dem rule
demselves. I remember dat time say una go think say Africa don get better ruler wey go be
sample to de rest of dem. Twenty years don pass de yeye man no want comot for power. de
country wey be say before him become ruler, people dey enjoy small. If you go there now,
plenty industry don pafuka. De people don sell their belongings when hungry want kill dem.
De small resources wey de country get, de man don make am him own. I laugh de oder day
when de man say Oyinbo wey dey against am na racist. De question I want ask am be say
wetin we go come call de kind thing wey he dey do him opponents. Plenty of dem don run
comot de country just like other country for Africa. As we know, Oyinbo people wey him dey
attack no be dem dey kill plenty opponent wey de man don send to their graves just like de
rest of our African Leaders wey no want comot for power. As I talk before and I go talk am
again, de thing wey our African Leaders dey do our Continent wowo pass de kind humilations
wey our people surfer under Oyinbo. When oyinbo dey do am at least we know say dem no be
like us, which kind excuse our yeye Leaders want tell us. If you go all de countries
oyinbo people rule for Asia and South America, their Leaders don improve their country,
wetin we gain from our African Brothers wey call demselves Leaders? Since Oyinbo comot for
Africa, which country una fit talk say their lives don better? Se na dis kind standard
Uncle Sege dey talk?
And if de man dey talk about our Army, I no
see one Obodo for Africa wey him Soldier no dabaru de country. From Congo to Liberia,
Ethiopia to Kenya, se na Nigeria our Obodo una want talk ni abi which country. De kind
surfer surfer wey we dey face for Nigeria now, which people cause am? No be our Army dem?
De only enemy wey dem fit fight na innocent People wey dey our Continent. If you say make
dem fight real men na Lehilehi dem go run. And de one wey think say dem sabi rule no be
ruin dem bring to our head? I know say I no pass Oyinbo Country before but I sabi say we
get plenty natural resources for Africa pass oder Continents put toghethr, but wetin de
thing bring us no be famine and war? And de people wey dey behind am sebi na our own kind?
I know una read and hear about Serria Leone and Angola, with all those diamonds, gold and
oil wey dem get, plenty of their citizens don turn to destitute as my brother for America
dey say. Small pikin wey for dey enjoy him youth kule, dem don turn dem to killers and
Gbana Boys. Se na dis kind standard our Uncle Aremu dey talk?
He fit be our Uncle Sege dey talk About our
NEPA wey don dey get problem before dem born me. Abi na road wey be say we go put all dis
money for am and two years later de thing don turn to pools wey frog dey live. De man fit
dey talk about our School wey him graduates no fit stand where pikin from other Continents
dey for book. If you go our University dem, you no fit find book read for de place and if
you get lucky find one, de thing na 50 years old. De pikin dem don turn to Asewos and
Assasins. And de ones wey dey call demselves Professors don turn to Market Women wey dey
Jankara. If you no pay dem money you no dey pass comot. De Asewo wey we get for our Obodo
pass all de doctors wey dem get for Obodo India. I guess na de kind standard wey our
President Obasanjo dey talk when he dey among his big belle Colleagues for Abuja dey talk
say Africa get standard.
Make we no deceive ourselves for Africa,
plenty people wey call demselves our Leaders na Ogbologbo Onyeochi and Killers. And de
thing wey dey shame me pass for de thing be say dem no dey shame atall atall. You go see
dem dey travel go Obodo Oyinbo conference like say dem be better person. You mean dem no
sabi say de Oyinbo people dey laugh dem? And small time when dis Oyinbo tell dem say make
dem spend money on deir people back home, dem go dey vex with Oyinbo say wetin de man
mean. As if to say oyinbo no sabi sabi where dem dey hide de money. De reason why Oyinbo
no dey respect our Leaders be say plenty of dem dey act like say deir brain na yansh he
dey. De only leader wey Oyinbo people respect for Africa na Mandela because de man sabi de
thing wey dem dey call Integrity. Which I know say plenty African Leaders no fit see even
if de thing slap dem for face.
So my people na him be dis o, Next time una
see our President, make una ask am about de Kind AFRICAN STANDARD wey him dey talk as
plenty of us no gree see am. Na here I go stop make una dey do jeje o.
March.25.2002
Wetin Be Dis 'Ours' For Oil Matter Self?
Life no easy my
people, country dey hard. How una dey before I start my fellow Obodians, I hope say una
dey survive? The thing wey I want talk today I know say plenty of my people for South East
no go dey happy about am but as I talk before, anything wey concern our people me I go
open my mouth even if people no like am.
For dis oil wey we get for Niger Delta
which people get am self? He don tay wey I dey hear my people for South East dey talk say
other tribes for Nigeria dey use their Resources dey take build their communities why the
people wey get the oil dey surfer. No person wey dey for our Obodo wey no go agree say
people for Niger Area dey surfer for the thing true true but the only problem wey I get
for the talk na dis "our Oil" wey our Leaders for South East dey talk. I no talk
say my people for South East no get oil for their area. But before last week I don hear am
plenty times wey my fellow Igbo especially the ones wey call themselves our Leader dem go
talk the thing. Na last week I come hear the thing again for meeting wey we do for Lagos.
When I hear the thing I come ask my self say why be say plenty times when our Igbo Leaders
dem want talk say other Nigerians dey use their Oil, na dat time dem go make my people wey
come from South South as one of dem. And the thing be say no person for dis our Obodo wey
no sabi say Calabar and Rivers no be Ibos. The thing come be like say the thing wey our
people for South East dey fight against na dat the same thing we want do to our people for
South South. Outsiders wey look the thing go think say we be wayo people.
Plenty people wey dey for Niger Delta area
na Ijaw, Efik, Isoko, Urhobo, Bini, Ibibio, Ilaje, Itsekiri. Then we come get some Anioma
and other group wey come from Asaba area. Na the only area wey we go fit talk say plenty
Igbo people dey be dat. But our Leaders for South East when dem want use wayos go dey talk
like say people wey come from the whole Eastern Region na our people. He don tay wey I don
dey hear my people for calabar and Ijaw talk him language, I no see one wey call him God
Chineke for the talk. As Yoruba people dey talk, Mama Mama Mama, Mama sabi how many pikin
she get. I no talk say we no get Oil for South East area but the thing be say he no good
make wey dey do the kind thing wey we talk say other Tribes dey do to us wey we no like.
Me I no like person wey dey take style dey use other people. Akwa Ibom, Cross Rivers,
Rivers, Delta, Edo and Ondo no dey speak Igbo except Delta area. I go even talk say if we
look history, Yoruba people fit claim Edo State since Bini and dem get history together.
No person wey no sabi say for Bini their King Akenzua na Oba dem dey call am. And I sabi
say for Ijaw area their King na Obi dem dey call am as we get for some part of Ibo.
But the thing wey I dey talk be say make our Leaders for South East dey talk like say the
people wey come from the area na only Ibo na him I no support.
For oil own the only people wey no fit talk
say their people dey there na my people wey be Hausa/Fulani. But as all of us be Nigeria,
the thing belong to all of us. I remember for 70s wey we dey take Groundnut dey make
Pyramid for North, no be all of us chop the money? So the thing be say the only people wey
fit talk say dat oil area na their own na South South people, so my fellow Igbos if we dey
talk say other Tribes dey use our resources I beg make wey no dey mention South South own
because we no too get people wey be our kinsmen for the area. Na Chineke I take beg
una, he go good make we stop dey talk like say Obot and Ekaete na Ibos. Na here I go stop
my people, make una dey do jeje o.
March.20.2002
Aso Rock Versus Natl. Assembly Fight Good For our
Obodo
How una dey my fellow
Obodian, I hope say una dey kampe. Today if person dey ride horse for my belle I no go
feel the pain o my people. Fight wey Uncle Sege and Speaker Na'bba dey fight come be like
say na for my backyard the thing dey happen.
My people na Democracy benefit na him we
dey enjoy be dat o for una wey no sabi . Since we don dey get regime for Nigeria, which
time una see wey two powers dat be dey nack heads wey blood no dey or one person no dey
for Kirikiri gulag? Una remember say when dis kind thing happen for Abacha era, na Prison
our brother Major General Diya found himself. And plenty people wey try am when Abacha and
his Mafia Monsters dey for power no be Assassin end their life for dem? And as for Yaradua
own (may his soul rest in peace), no be AIDS Vaccine I hear say dem take inject his body?
But dis one own, as Hired Assassin matter never enter am, me I go take time enjoy the
thing to the fullest. Person wey no support dis kind fight for our Obodo no be our friends
at all. He go good make the person pack commot because dis fight na the kind thing wey go
make our Country proper for Superpower rank be dat. Sebi una remember say when Clinton for
America dey for power no be everyday the man and Republican dey fight? I know say our own
dey crooked small since Uncle Sege and Speaker Na'bba na same Party dem dey. Na dis make
our own sweet pass be dat, and I dey enjoy am so tey, I no dey dey hungry for house again.
For una wey no sabi why the thing dey make
me happy, I go explain am to una small. Na all of us sabi say plenty of our so call
Leaders and Politicians na Ogbologbo for Barawo own. If una dey talk about people wey go
thief your money and still stand kampe for your front na our Leaders be dat. Any money wey
come their way friam, dem go sweep am shuam. Suddenly the thing don disppear puam just
like dat. For mone matter, dem no dey shame. Money wey you no want make dissapear you no
dey put am for their face, because if you blink, the thing don find himself for their
Foreign Account without trace. So my people as dis fight dey so, na him be say plenty of
dem go think before dem chop our money since none of dem want make him enemy embarrass am
for Public. For our Obodo now, no Politician dey safe as plots upon plots be music of the
day, the ones wey no dey for power yet dey plan how dem go take comot person wey dey for
Governor House. Una remember say since dis their fight, na soso talk say dem go audit
demselves na him we dey hear. Last month when our President tell Finance Minister say make
dem no pay our National Assembly, the Reps too talk say dem go setup committee wey go
probe Uncle Sege and his Cabinets. When our President hear dat, him too ask the Accountant
General say make he probe National Assembly account. Na him be say any of dis people wey
don thief or hide some money, must now take style bring am back before the thing wey him
cook wey house burn splash splash all over Newspapers front page across our Obodo. Na this
kind thing wey fit make our Leaders dem slow down small and begin dey do better thing for
position wey we put dem. If dis thing continue like dis, I go fit talk now say Progress
Light go start dey creep small small dey enter our Country. And our prayer be say dis kind
thing go make our Leaders shed their wayo clothes and start dey do things wey go move our
country forward. And for us wey dey chop gari everyday, na him be say Rice and Okueko
(Lagos Fish) go soon dey enter our Almighty Belle be dat. So my fellow Obodians, na here I
go stop make una dey do jeje o.
March.08.2002
Oga Olopa/Soja Where You Dey Work?
How life my people, I hope una dey
kampe? Tory wey I get today I wan make una think about am well well. Dis thing fit change
una life and our Obodo. The first thing be say plenty of those OC and Soja dem wey our
government sack because dem dey do magomago or thief for work where dem dey and which kind
work dem dey do as we dey talk now? We know say as our country dey so he no dey easy.
Plenty people no fit find work do, na him make me ask say those Soja and Police wey dem
sack who dey monitor dem and how we tay know say dem no go the thing wey dem take comot
dem for office again? I know say plenty of una go dey wonder why I dey ask dis question.
The reason be say plenty time we go hear or read am say our Goverment sack some Olopa
because dem catch am dey take bribe or dem see dem dey carry another person thing go home.
And sometimes na Oga Soja we go hear say dem find am dey drink for work or say he carry
him gun go home when he no get permission. How we tay know say dem no be Jaguda wey dey
rob us for night everyday for our Obodo?
I remember last Christmas wey dem talk am
for paper say Government comot some Olopa and their Oga for office because weapons wey dem
talk say make dem dey watch dem no fit find am. When the Oga patapata hear am he come sack
all of dem and their Inspector. But the thing wey I no sabi be say everytime wey dis kind
thing happen our Government no dey put dis people for Jail. Dem believe say since dem don
sack dem dat one dey enough. Wetin make dem think say dis people no fit go sell the gun
and collect plenty money for the thing. He believe like say make I be Oga Olopa and dem
come put me in charge make I dey watch Guns wey dey our Station. Let say I come sell the
guns Robbers and collect about 500,000 naira from dem. Una think say I go cry if my Oga
sack me for the thing? Sebi I know say dat kind money I no fit get am for Force even I dey
there for 10 years. The thing be say as crime dey increase so for our Obodo, I go think
say our Leaders dem go ask why be say plenty robbers too dey get gun wey better Police
own. Or where the people dey get dat kind gun when no be say we get Gun Factory for
Nigeria?
Even self the Oga Soja/Police wey no get
money for one corner, how he tay dey survive when dem don sack for work? If he dey work,
which kind work he dey do? I no think say I dey wrong if I talk say plenty of those people
don turn to Armed Robber. The reason I talk so be say, plenty time when we hear for News,
Police go talk say the robbers dey behave like say dem get some military training. Another
thing be say the robbers wey we get for Nigeria now too dey escape from Olopa, na him be
say dem fit sabi how our Police dey work. Make una look am my people, se una wan tell me
say una no sabi say the witch wey crow last night na him kill the pikin wey die today? If
to say our Leaders dem get some sense dem go dey monitor all those yeye OC /Soja dem wey
dem sack for office. I fit bet una say plenty of dem dey involve for the killing wey dem
happen for our Obodo. How una think say the people dey live my fellow Obodians since we
know say work no too dey for our Country and plenty of those Barawos na Standard Six dem
tay enter Military?
My people na so I see am o, anytime wey una
see OC/Soldier for una area wey una hear say he no get work make una watch am well well
because he fit dey spy for those Killers wey dey come rob una for night. Na here I go stop
I hope say una go think about the thing o before he happen to una.. But na God I tay beg
una, make una no go lynch innocent man wey dey mind him business jeje.
March.06.2002
My
People Politics Plenty For Our Obodo
How una dey fellow Obodians, our life go better one day make una cool
temper. But we no fit talk so for our Democracy own. The kind politics wey we dey play for
Nigeria don tire me. Why be say our Leaders no fit campaign unless dem talk about which
tribe dem born dem. If to say dem dey young I go talk say na because dem be small pikin na
him dey cause am. But as the thing be plenty of dis people dem don tay wey dem don dey for
politics. Dis talk say Democracy dey young for our Obodo me I no buy am because politics
don dey around for a long time. Na everywhere we dey na him we dey play politics. For
market he dey, Hospital o the thing plenty. And for Military own, dat one na ogbologbo.
How una think say people like Abacha, Diya, Idiagbon, Obasanjo, Buhari and Banbangida tay
reach their positions? No be say dem sell out for Army? So my people he don reach time wey
we go stop dey find yeye excuse for our Leaders say because Democracy dey young for our
Obodo.
Which time una open Newspaper wey una no
see wey some Leaders dey talk say Northerners no go vote for Obasanjo because he too no
give dem contract or Yoruba people go talk say make dem vote for Obasanjo since the man na
one of dem. And if we no read dat one for Paper we go hear for Radio say Igbo people no go
vote for Obasanjo as he no treat their people well. I even hear wey our so call Leaders
from East dey talk say for 2003 Election na Candidates wey get Ibo Agenda na him dem go
support. Which kind nonsense be dat, which one be Ibo agenda? And our Leaders for Arewa
also talk say Hausa/Fulani people no go support Uncle Sege because na people wey no vote
for am na him he dey put for Post. You mean dis people vote for am so he go put their
people there or abi na because the man go do better job, which one we dey self for
Nigeria. For South west, you no fit sabi whether Afenifere and AD na the same because
everytime wey person open mouth for AD na Yoruba matters you go hear. He go good if dem
name am Yoruba Party instead wey dem go dey take am deceive people like say other people
matter for their party.
So my people how our country go take
progress if na dis kind tribal politics we go dey play. Even self all dis yeye politicians
wey dey call themselves our Leaders wetin tell dem say our people go even listen to dem at
all. All dis yeye people self wetin dem do for their people self?. Why be say na only time
wey dem go remember us be say when dem want run for Post? When our brother Ekwueme dey for
Post, how many Ibo benefit from am? No be only him immediate family and his rogue friends
dey chop the money? Plenty of our leaders wey dey for Arewa don dey for politics even
before dem born my mama, which kind good the thing bring to my people for Sabogari. If you
go my state for Sokoto you go see plenty people wey dey beg for road, se dem want tell me
say Babangida, Buhari and Abacha no be Northerners? The money dem thief dey for London
where dem take take am buy mansions for Oyinbo Country. And my Yoruba brothers na the same
Barawos, plenty na oga patapata when Army dey there, na because of their greed na him make
plenty of our pikin dem dey drive taxi with their Degree for Oyinbo. Our country for don
better if plenty of those pikin dey here dey work. I hear say if you go Oyinbo Country, na
so our people full am. All the brain wey dem for dey put dey improve our country, Oyinbo
don take am better him country.
With all dis tribal politics, wetin dem
want make my people for Niger Delta and Middle Belt come do? How person from dat area go
come rule our country if all those Yoruba, Ibo/Igbo and Hausa/Fulani continue dey practice
dis there own flavour for Politics? Na wa o my people.
As I want stop here my fellow Obodians, I
hope una remember say plenty of dis our so call Leader na enemy of the states as Will
Smith talk for him movie. Dem no mean well for us, as old dem be, we no fit talk say na
dis better thing dem do for our country. Na beg I tay beg una, if dem carry their wahala
say make you no vote for person because him no be from your area or abi because the person
na your chief pikin for village make una elect am, na cutlass make you tay drive dem comot
for your house. Na person wey we think say he go do better thing for our country na him
want even if the person na from Niger Delta or no be from our area.
March.01.2002
Senator
Pa 'Mugo For President
My people for una wey no hear, una
Honourable Pa "mugo go run for Presidential Election. I don talk the thing with my
family dem and dem dey gbagbarangba for my back. And as una sabi for Politics, dem no get
choice since dem know say if I win the thing the person wey no support me no dey enter Aso
Rock for Abuja. I go do my Press Conference tomorrow for our village. I know say plenty of
una dey laugh me as una dey read the thing. Make una dey laugh o, una go soon dey call me
your Excellency.
My fellow Obodians I go give una hint small
how my regime go be. The first thing be say during my term, I go ask all my Ministers dem
make dem sign paper say dem no go chop money and if we catch dem dey do magomago na him be
say we go seize all the property wey dem get for this life. Another thing be say person
wey want become Minister during my term, no go get salary till we finish, as our country
no fit afford am. We go do like dem dey do for Oyinbo corporate world, where be say na
when person don make company better na him dem go give am plenty bonus. So for us after
our country don better well well na him we go receive money.
As for our National
Assembly dem wey be say na only dem dey enjoy Democracy, dat
one no go happen for Pa Mugo own since me wey be president no
go get money, I wonder how dem go tay pay themselves benefit
and allowance wey person fit take build mansion for Lekki. I
know say if we comot money for Politics for Nigeria, plenty
of dis yeye Politician dem no go run for post as dem go know
say money no dey for the thing again.
But my people the
only people wey go enjoy better salary during my time na dis
our Military and Police dem including Teacher, Doctor, Nurse
and Yellow Fever. Since I know say if our country go progress
na only when dis people dey happy na him the thing go happen.
If we pay our Military and Police dem well well, plenty of dis
killings wey dey happen everyday for our obodo go reduce. I
no go lie to una, me I believe say our Police dem sabi the people
wey be robbers and assasin for our Obodo. Una know say country
and Leader wey him people dey happy for their life go get peace.
Na because our Leaders no treat the rest of us well na him make
our country no get peace. As dem talk for my village, pikin
wey no let him mama sleep him too no go fit sleep. If our Leaders
treat us well, all dis strike and riot no go too dey.
My people na my Campagn Platform be dat o,
na him be say Uncle Sege and IB no get anything on me. For una wey dey laugh before, se
una don hear am now?.
Another thing wey I go change na him be dis
Contract own. Person and company wey want contract go first take him money do am. We go
come put am for paper make people go the place go see am. Na when People and Press don
talk say dem do am well, na him we go pay dem. Dis kind thing go stop Chicken Estate wey
our Leaders dem call Housing Estate. The people wey go live for the thing no go pay
goverment if the building and road for the place no dey kampe.
All dis project own wey IMF and World Bank
dey give, na dem go supervise the thing. Na him be say if Contractor no do am well, we no
owe dem anything. Na dis kind thing go make IMF and World Bank dem think twice before dem
award project to their friends and come dey ask our Obodo make he pay for the thing. The
people wey talk say World Bank na rogue no lie. I wonder why dem no fit monitor the people
wey dem give money if dem too no dey do magomago?
Na here I go stop make una dey do jeje o.
February.22.2002
CNN
Reporter No Be The Problem
How una dey my fellow Obodians, I
hope say una dey kampe? Wetin be all dis hilahilo wey I dey hear from our Politicians dem
about CNN report? For una wey no sabi the question, no be last week or so we hear say one
Reporter for CNN talk say some people for our Obodo dey talk say dem want make Soldier
come back. Since dat day na him our Politicians and some Leaders don dey talk say make dem
comot the Reporter wey talk so for Television. I even hear say our Governor for Lagos talk
say him go ask him Commissioner for Justice make he carry CNN go court. Governor Tinubu
talk say because of the report some Chinese people wey want come do business for Nigeria
change their mind when dem hear the thing. My people se una dey hear our Governor, na him
be say the yeye man want make the Chinese people come put their money for Nigeria, se he
want tell me say dat one no go put their life for danger especially when wahala dey for
ground? I guess say the man no too care about the people if dem live or not, him just want
their money for Lagos. If na me be the Chinese people, I no think say I go do business
with our Governor again. Na him be say because of money the man fit put their lives for
danger. Na dis kind thing dey cause plenty Foreigners wey dem no want do business with us
as he be say our people fit kill their Mama for Money.
So my people the question wey I want ask
our Politicians be say why dem no fit put dis kind energy for things wey go move our
country forward. Every time wey we hear say Foreigners make mistake for our Obodo na so
you go see our Leaders dem go jump on dem like Ants wey surround Sugar. I wonder why dem
no protest when the yeye Federal Salary Commission or wetin dem dey call dem award dem
plenty money for Salary?
As for dis CNN report me I no see anything
bad for the thing. As dem dey talk for my village dem, if smoke no dey we no go see fire.
If we no get problem the reporter no go talk am for Television. The question wey I want
ask all dis people wey want fight CNN, se dem want tell me say the Hausa pikin dem wey
carry poster say dem want makw Army come back no be Nigerians? As I hear say he dey for
our Constitution say we fit talk if we no agree with our Government, I no think say he dey
wrong say the people say dem want make Khaki boys come rule us again. Dat one na their
"God/Allah given right" as dem dey talk for Obodo Oyinbo. I no sabi why we no
want make the Reporter report the thing wey he take him Korokoro eyes see.. Why be say for
our Obodo when reporter talk something wey we especially our Leaders dem, na dat time we
go call the reporters all kind names? As for some of my fellow Obodians wey dey protest
when dem hear CNN report, I dey sorry for dem. Because na dis type Reporters we need for
our Obodo o, no be those yeye Journalists wey our Politicians don bribe finish. If our
Leaders start dey do magomago or dey yamutu (kill) their opponent, how dem think other
country go hear the thing if reporter no talk am for Television or Papers? Dis Democracy
wey some people dey enjoy now, se dem think say na because of us na him make Khaki boys
talk say dem no want power again? My people make we no lie to ourselves. No be say we no
dey involve for the thing but na because of tory wey people for other country hear about
our suffer suffer for CNN and all other News organisations na him make the people push
pressure for our Army dem. If to say other country no hear the thing, we go still dey
under Military dey cry suffer suffer for Nigeria o my people.
So the thing wey I go talk be say, we need
those news organizations. I sabi say no be everytime dem go write better thing about our
country but the thing wey I go tell una be say, if we no do bad things the people no go
write am, and plenty of dis our yeye Politicians wey dey attack dem, I no sabi why dem no
fit fix the thing wey dey cause palaver for our Obodo instead wey dem dey attack the
messeger. If people no carry poster for Idi Araba, CNN no go report am for news and if our
pikin dem get work when dem comot University, we no go dey see fight and wahala everytime
we waka. All the palavar wey we dey face for Nigeria go reduce if our Leaders dem do
better job instead wey dem dey fill their pockets with our money. So my fellow Obodians,
na the thing wey dey cause riot for our Obodo be dat o. I want stop for here make una dey
do jeje o.
February.18.2002
I Beg
No More State for Our Obodo
My people I no too sabi our people
o. Some ideas wey if dem pratice am for another coutnry he no go get K leg but if dem
bring am to our Obodo the thing no go work.
Na dis kind thing bring me to palavar wey
dey happen for our Obodo since our Government start dey create States. Me I dey among
people wey talk say he good as our Leaders dey create states as the thing go bring
progress to plenty of our community. But as the thing be now, na him dey cause plenty
katakata wey dey happen for our Obodo. Why the thing dey cause palavar na him I no sabi.
Make we take the wahala wey the thing don cause between Ekiti and Ondo States. Dis two
states before dey break am to two na the same o. The people no get the kind wahala wey we
dey hear for News everyday.
One thing wey bad about the thing be say
dis na tw States wey be say their Mama Language na Yoruba, before dem consider themselves
as one but since our government cut dem into two na him the politicians don dey cause
wahala for themselves. And the two Governors wey you go think say dem go behave like
father figures don turn the thing to war. The thing wey I want ask the two Governors be
say wetin go happen if our National leaders come decide say make dem return the affairs of
our Obodo to the time wey our Ex Head of States General Yakubu Gowon dey for power wey be
say na only 12 States we get? If the two Governor come dey fight for one State wetin the
Governor for Ondo want tell the people for Ekiti wey he don sack for work because dem no
come from Ondo? And I go ask our Ekiti Governor the same thing, which kind mouth the two
of una go fit ask the people make dem vote for una as una don turn the peace loving people
to ball wey una dey play back and forth because una be govenor or una want win election?
If una no sabi well well, anything wey una sow na him una go reap and I no think say he go
tay before God go repay una for the thing.
I hear from my source say the yeye
governors dem dey fight how dem go take divide Ondo States properties? If the yeye
governors dem no sabi, plenty people wey come outside old Ondo States no fit sabi which of
una people be Ekiti and which be Ondo since una dey talk the same way? The question I want
ask una be say wetin go happen if una no be the same tribe na him be say una go don turn
the area to War zone? I hope say my fellow Ekitis and Ondos no vote for una for dis coming
election as una no be better leaders.
My people dis kind thing dey all over
Nigeria o, Akwa Ibom and Calabar too dey force because of things wey to me no dey
important. Na so Abia and Enugu too dey fight. I also hear from my Source say na the kind
thing wey dey cause wahala for Taraba, Plateau, Benue areas be dat. Plenty of dis people
use to be one o, but since our yeye Leaders dem start dis their yeye Politics na him
everything don dabaru (upside down) like Tailor legs. Our Politicians don turn the thing
to weapon wey dem fit take win elections. I dey pray say my people go fit see through dis
yeye leaders dem and drive dem comot for power.
My advice to our Leaders be say since the
thing wey we think say go bring Progress to our People don become the thing wey
Politicians dey use dey turn people against themselves I hope say we no go dey create any
yeye states again. He don do Mr. President, we no want another states again, the one wey
una create na death he dey bring to our communites dem. Haba na wetin, Se na by force. Dis
politics self I no sabi why our Royal Fathers no fit advice our Leaders make dem comot the
incentive wey dey make people want dat power at all cost, na him be say make dem remove
the money wey dem want kill themselves for, na dat time wey go sabi which of dis Barawos
like our country pass.
Na here I go stop my people, make una take
am jeje o.
February.13.2002
Honourable,
Una No Dey Shame?
My people he be like say dis our
honourable dem no get shame for body. Sebi na everybody sabi say na because of work wey no
dey for our Obodo Nigeria na him dey cause palavar for Obodo. All dis pikin dem na because
dem no get work na him make dem dey cause wahala. Frustration don turn their head finish,
plenty of dem don dey kolo small. As dem dey talk for Oyinbo country idle man na dangerous
man. Since plenty of dis pikin no fit find work there motto don become "Man must
survive". Na him cause dem dey go Ministry of Arm Robber & Hire Killer dey look
for work. Hungry don kill their gumption finish patapata.
And with all dis surfer surfer wey plenty
of dis pikin dem surfer una go expect say our Leaders dem go find something for dem. But
no be for our Obodo o, our Honourable dem dey act like say na another planet dem dey. Se
una hear last week wey Obasanjo dey talk say he no support make dem pay dem new salary wey
those yeye National Revenue Mobilisation and Fiscal Commission approve for dem last year
and talk say make dem explain to am how much money he be and how dem take arrive for the
thing.. I come hear say National Assembly talk say dem go get dat money even by force and
talk say the thing no concern our President. For una wey no sabi the amount, according to
my source for Abuja, our Honourable dem go receive N794,000 for salary plus 350% of their
salary for allowance. My people una dey hear, when everybody dey talk for our Obodo say
dem never see reward wey dis yeye democracy bring for dem, our National Assembly dey
gbaladun for house with their family dey enjoy their own. Which kind country we dey self
wey everything dey pafuka left and right but the people wey dey in charge dey award money
for themselves? I no sabi dis one o, sebi na Nigeria dem born dis our Honourable dem, una
mean say as our country dey so no concern dem? How dem dey sleep for night I no sabi my
people. Una go expect say since the country no progress atall, dem no go take dat new
salary even if dem force dem. But no be so for our so call Leaders dem. Greed don eat
their brain finish, na only dem own dem sabi. Which kind thing dem do self for our Obodo
wey make dem think say dem deserve dat big RAISE? My people I no go lie to una, dis kind
people no deserve our votes, una go expect say dem no go even take one kobo as our country
don pafuka finish. Shame no dey for their body.
My people as I want stop here, na beg I dey
beg una say next year during election make we make sure say no person for dis our National
Assembly go return to dat building. As he be say na only their own dem sabi. Una mean say
not even one Honourable fit talk say make dem no pay dem dis salary since plenty people
for our Obodo dey surfer. He be like say our own don finish o for Naija as he be say na
Thieves dem be our Protectors................................
February.08.2002
Our
Green Eagles Na Disgrace
My people why be say nothing dey
work for dis our great nation. Our leaders plenty of dem na barawos, and as for our
government dat one na another matter. You no fit ask dem for anything. You go our Ministry
go ask for form, dem go tell you say the machine wey dey print am no dey work again. And
if dem no tell you dat, dem go talk say the person wey dem in charge don go leave. And the
only thing wey join us together as one nation since na everyday we dey kill ourselves na
soccer. And dat one too no be the kind thing wey you go bet your money.
From begining wey dem start dat African Cup
na him I don know say we no dey go anywhere for the thing. I no sabi for una o, but as for
me all the team wey we beat for the Tournament na luck we take beat dem no be say our boys
play better. The thing wey I no sabi be say with the kind talent wey we get for the team I
no sabi why we no fit score goals against of our opponent. And the guys self no get
discipline as na the thing wey dem want na him the big belle coach go do.
No be two days ago I dey tell some people
say our Super Eagles no go win dat cup. I even tell dem say I no think say dem go fit beat
Senegal. But plenty of dem tell me say I no sabi the thing wey I dey talk. Dem talk na
only Brasil get talent pass us, say small Senegal he go reach 4 goals wey we go put for
their net. My people se una dey hear, na the kind talk wey dey kill us for our Obodo be
dat, because we too dey boast and we no fit back am up. Na soso mouth we get we no get
action as dem dey talk for Obodo Oyinbo. I tell the people say the kind problem wey we get
na him dey affect Brasil now as dem think say for soccer, the only thing wey dem go do be
say make dem just show up and dem go win. He don tay wey dat kind thing don dey kill us
and we no dey learn. The problem I get with us be say we no dey learn from our mistake.
Some people when dem make mistake dem go correct next time, but dat one no be so for our
people and he go continue to kill us.
Make I start with our NFA leaders dem, he
don tay wey money palavar don dey cause problem between dem and our players. Our Leaders
dem go promise the players say na soso money dem go give dem but small time una go hear
say some leaders dem don chop the money. As soon as the players hear dat, dem go dey
behave like say na their last kobo na him the people chop. Una go hear wey dem go talk say
dem no go play again. No be say I support the players but the thing for my book be say if
NFA don agree say na soso money dem go give the boys make dem honour the contract. The
thing happen for World Cup 94 for America, he happen again for France98, and na the same
thing dey happen for dis African Cup own. Any time wey something don dey go smooth our
Leaders go find thing wey go just dabaru the progress. Una remember say the players no
want go Mali if to say our Supporter Club no give dem money aas our yeye NFA don chop the
money as usual. I no sabi the thing atall atall my fellow Obodians, if our Leaders dem fit
award big Salary for our National Assembly dem, and allow Uncle Sege make he use money wey
fit buy plenty African countries buy Presidential Plane, I no sabi why we no fit pay our
Super Eagles money for Soccer. Dat one pass me o my people, and dis na the only thing wey
we fit talk say unite us together.
As for our Players dem, the people wey talk
say dem get Mafia for the Team no dey lie, na true dem talk. Plenty of our players their
mouth don big and I no sabi why we still dey allow dem for the thing. Make I talk about
dat money first, una remeber say I talk am before say if NFA don agree say dem go pay dem
money, he no good if dem come talk say dem no go pay dem the amount again. Me too no go
gree for dat kind thing. But the thing be say plenty of dis our players na millionaires,
we no talk for Naira I dey talk Pounds and Dollars. And for Naira own, half of dem na
Billionaires. So my brothers, una want tell me say dem no fit do dis thing for our Obodo?
Where dat pride dey self wey dem go talk say dem represent their Obodo Nigeria for soccer.
I beg make una no answer dat one, we know say dat one no dey work for our great Country.
The thing start from our Leaders- from Uncle Sege head come pass our National Assembly dem
down to poor people like us. The thing wey Oyinbo dey call "PATRIOTISM" no dey
work for our Obodo, dat one na Whiteman affairs.Dem go talk say na dat one dem go chop.
Se be una see the tournament, our boys no
play like say dem dey hungry for the thing. Dem just dey play like say na dem be Michael
Jordan for Soccer. The only person wey dey agressive for the match na Julius Aghahowa, the
bobo wey score three goals for the tournament. Okocha, Kanu, Oliseh, Finidi and the rest
of dem just dey play like say dem no get leg. Dem dey so slow you go thing say na my
grandmother for village dey waka, dem go dey wait for ball instead make dem play like team
wey get mission for hand. You go expect Cameroon wey be defending champion dey play like
dat but na our Super Eagles dey behave like say na dem be champion. Sebi una see Cameroon,
the boys dem na no nonsense. Dem dey play like say dem want the thing again. I go dey
surprise if the boys dem no carry the cup again.
My advice to our Leaders dem be say he go
good make dem start dey play those young boys wey still dey hungry for the thing, no be
dis our current players wey their ego big pass our National Stadium and no action . The
thing wey I no sabi for dem be say, wetin dem win for us lately? The only time wey dem
shine na for dat olympics wey dem win Gold. Sebi una see Cameroon dem, dem win African
Champion and Olympic Gold two years ago, and dem go win dat African Cup again dis year.
But for our boys na yanga dem go dey do wakaabout like say dem be Brazil. If you want do
yanga, at least you go don win World Cup, no be dis underachievers wey no fit beat Mali
and Senegal. Sebi una see the match, we play against 10 players and we no fit beat dem. Na
wa o my people, our boys dey useless. Make una no dey surprise if we no win one one match
for the thing. We play five games and na only 4 goals we fit manage. Dat na disgrace.
My people na here I go stop, I dey pray say
our Leaders dem go sack all those yeye NFA including our Super Eagle Coach and his staff.
And as for the players, if we want shine small for World Cup I hope say dem go put all
those young boys wey dey sitdown for bench instead of those Okocha dem wey dey play like
say dem old pass my mama. We need new blood as Oyinbo people dey talk am, and dat our
Goalkeeper (Ike Shorunmu) even yeye pass Rufai own. Dis one na real BASKET.
February.06.2002
Strike
Don Become Yeye For Our Obodo
He don shele o my people, and the way wey we dey go, we go soon turn our
Obodo to country wey the only thing we sabi na strike. I no talk say make workers no
strike if Government or the people wey dem dey work for no want pay dem. Or for situation
wey be say dem no dey treat dem well. But the kind one wey we be say na every day workers
go dey strike na him I no support. The way we dey do am now, the thing don become yeye. If
Teachers no strike today, Lecturer for University go strike. And soon as dem finish their
strike, our Doctor go begin their own. When those people don finish, na Nurse go start
their own. The thing don become weapon for Nigeria wey be say anything wey workers get
problem with their Employer, na strike go be the next thing. I even hear say House Maids
and Night Watchmen too don dey plan their own strike too. For una wey be Olowo (Rich
Folks) dem make una get ready, because if dis people start their own na him be say Oga go
dey outside dey watch the house while Madam go dey inside dey wash Plates. Na play I dey
play for dat one. But una know say for our Obodo anything fit happen.
But make we dey serious small my fellow
Obodians, the way we dey do dis thing don become something wey I no fit support. I sabi
well well say our government na yeye especially the people wey we call our Leaders. No be
say Doctors and Nurse no fit strike if our our Goverment no gree pay dem in time but the
thing be say he for good make dem find another way wey dem go fit punish our Government
dem. Na all of us sabi say the people wey dey work for Private Hospital dem make money
pass Workers wey dey for General Hospital. But na poor people dey surfer anytime wey LUTH
Doctors strike. Una know say plenty of our Leaders na Obodo Oyinbo dem dey go even for
cough. Una remember the last time wey Doctors strike na so we hear say people just dey die
for Hospital like chicken as Doctors no dey around. The thing be say some work
(Profession) I no think say he dey proper make dem dey strike. If dem want do am, no be
all of dem go do am at the same time. Na all of us sabi say we no too get plenty Hospital
for Nigeria and the private own na only person wey get money fit afford am. Na the one wey
our Government build na him poor people like us dey go. Se dis doctors and Nurse no sabi
say if dem strike na Mekunu like me go surfer. Se dem think say our Government care if dem
no go work. He no concern dem since dem no say na only poor people go suffer am. I beg
Doctor sebi na dis our Obodo una dey, which time una see wey our Leaders dem do something
wey poor go enjoy. Anytime wey Doctors dem strike na our Leaders Friends wey get Hospital
na dem go make money. Another thing be say anytime wey Doctors and Nurse strike na him be
say plenty people go die. And few people go just sit down for house dey surfer or make dem
go Babalawo (Natvie Doctor) house. Se na the kind thing wey our Doctors/Nurse want be dat?
But I no sabi why this kind thing dey surprise me self since I know say he don tay wey our
Doctors care if poor people like us live. For Nigeria, plenty Doctors don become business
people, if you no get money dem no dey treat you dat one na fact. Na him be say if person
get disease wey fit kill person dat na tough luck my people. I even hear say some doctors
wey dey work for General Hospital since plenty of dem get their own Hospital, dem go ask
you make you buy two medicine and give you on make you use and dem go come take the other
one to their own Hospital. Na wa o, our country don woh woh.
Another one na dis our Police dem wey want
strike. Why be say we too dey copy for Nigeria? Any time wey person start something for
our Obodo, he no go tay wey other people too go copy am. Na follow follow go kill us for
Nigeria. As I talk before the kind money wey our Government dey pay Police dem, no wonder
plenty of dem dey join Men of underworld. Which kind person fit survive with dat small
change wey our Leaders dey call Salary. Sometime when I see Police wey dey waka for road,
I go just shake my head for am. True true the people dey surfer but I still no support
make dem strike. Which kind person dey advice our Olopa dem self. I sabi say our
Government no dey treat dem proper. But no be person force dem make dem join Police abi?
Sebi no be by force. If dem get problem with our Leaders dem, dem for find another way.
Dis kind thing wey Police go dey strike I no sabi dat one o my people. Police dey work our
life still no dey safe. We no fit go party for Night again. Anytime wey we sleep we no fit
close our eyes as Armed Robbers don become Landlord for our Obodo. If dem ask you make you
open your door if you no do am na him be say the person want go visit him Papa wey don die
be dat. So my people, una sabi say if our Police too strike na him be say Armed Robbers
don get promotions be dat. From Landlord to Governor, na him be say their own don beter
and our own don doom.be dat. Who go stop dem, Se na those Olode (Night watchmen) go stop
dem abi na Yellow Fever you want make he come fight dem. My people the day wey una hear
say our Olopa dey strike, na our Village una go find me. I know say I no get money wey
Thief want thief but the thing be say those robbers if you no fit find dem money dem go
just yamutu the person just like dat. And as for me o, I no want die for Armed robber
hand. So my people he go good if our Leaders and Olopa dem talk o. If not na him be say
our own don end for Lagos be dat o.As I see the strike own he don become big business for
our Obodo. And na dat yeye NLC Boss cause.
My people dis strike na our country we dey
hurt. Una know say our obodo still dey struggle, plenty people for Nigeria no get work. If
all dis strike matter continue una know say few people wey get work go lose am since
company no fit make money when him workers no work. Una see the thing wey strike dey do
our pikin dem for school. Plenty of dis pikin dem wey dey for our University dem no sabi
anything |